Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Job 10

1 I don tire to dey live. Hear my bitter complain.

2 God, no condemn me. Tell me wetin be the charge against me?

3 E dey right as you dey wicked to dey hate wetin you make yourself? And con laugh on top wetin the wicked people plan?

4 Shey you dey see things the way we dey see am?

5 Shey your life short like our own?

6 Why you con dey trace all my sin and hunt down every fault wey I get?

7 You know say I no dey guilty, and say nobody fit save me from you.

8 Na your hand form and shape me, and now the same hand dey destroy me.

9 Remember say na from clay you make me; shey you go crush me back to dust?

10 You give my father strength make he bring me come life; you make me grow for my mama belle.

11 You form my body with bone and cover the bone with muscle and skin.

12 You don give me life and love wey no dey change, and I dey alive because you don dey care for me.

13 But now I know say all that time you just dey plan to do me bad.

14 You dey watch to see if I go sin, so that you no go fit gree forgive me.

15 If I just sin, I don enter trouble with you, but when I do right, I no dey get credit. I no dey happy and shame don cover me.

16 If I get any success at all, you dey hunt me down like lion; you even dey do miracle to wound me.

17 You dey always get witness against me; your anger dey grow and grow for me; you dey always plan new attack.

18 God, why you allow make dem born me? I suppose don die before anyone see me.

19 Make I go from my mama belle straight to grave for make sense pass make I dey exist.

20 Shey my life never finish? Leave me alone! Make I enjoy the time wey remain for me to live.

21 I dey go soon and I no go ever come back - I dey go to a land wey dark,

22 land of darkness, shadows, and confusion, where light sef na darkness.

Open Bible reader