Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Jeremiah 30

1 The LORD, God of Israel,

2 Tell me say: “Write down everything wey I don tell you for book,

3 Because the time dey come when I go bring back my people, Israel and Judah. I go bring them back to the land wey I give their ancestors and dem go own am again. I, the LORD, don talk.”

4 God tell people of Israel and Judah say:

5 “I hear cry of terror, cry of fear and not of peace.

6 Now make una stop and think! Shey man fit born pikin? Why I con dey see every man dey put hand for him belle like woman wey dey labour? Why everybody dey look sad?

7 A terrible day dey come; no other day go be like am- time of pain for my people, but dem go survive.”

8 The LORD Almighty talk say: “When that day show, I go break the yoke wey dey round their neck and I go remove their chain, and dem no go be slave of foreigners again.

9 Instead, dem go serve me, the LORD their God, and descendant of David, wey I go put for throne as king.

10 “My people, make una no fear; people of Israel, make una no fear. I go rescue una from that far land, from the place wey una be prisoner. Una go come back home and go live in peace; una go dey safe and no one go make una fear.

11 I go come to una and save una. I go destroy all nations where I don scater una go, but I no go destroy una. I no go allow una go unpunished; but when I punish una, I go dey good. I, the LORD, don talk.”

12 God tell him people say, “Una wounds no get cure, una injury no fit heal.

13 No one to take care of una, una wound no get treatment, una healing no get hope.

14 All una lovers don forget una; dem no care about una again. I don attack una like enemy, una punishment don dey terrible because una sins plenty and una wickedness great.

15 Make una no complain again about una injury, cure no dey for una. Na me punish una like this because una sin too plenty and una wickedness great.

16 But now, I go destroy those wey destroy una, and I go take una enemy away as prisoners, I go oppress those wey oppress una, and I go rob those wey rob una.

17 I go make una well again; I go heal una wound, though una enemy talk say, ‘Zion na rejected place; nobody dey care about her.’ I, the LORD, don talk.”

18 God say, “I go bring my people back to their land and I go have mercy on top every family; I go rebuild Jerusalem and I go rebuild him palace.

19 People wey dey live for there go sing praise, dem go shout for joy. Dem go increase in number by my blessing; my blessings go bring honour to them.

20 I go restore the nation ancient power and I go make am strong again; I go punish those wey oppress them.

21 Their rulers go come from their own nation, their prince go come from their own people.

22 He go come meet me when I invite him, because who fit try come to me if I no invite am? Dem go be my people and I go be their God. I, the LORD, don talk.”

23 God anger na storm, a terrible wind wey go destroy the head of the wicked.

24 E no go end until he don do all wey he wan do. In days to come him people go understand this clearly.

Open Bible reader