Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Jeremiah 10

1 People of Israel, make una hear the message wey God get for una.

2 He talk say, “Make una no follow the way of other nation; make abnormal things for sky no disturb una, even though say other nation dey fear.

3 These people religion na useless religion. Dem cut down tree from forest; dem carve am with tools,

4 And dem decorate am with silver and gold. Dem lock am down with nail so that e no go fall down.

5 That kind idol be like something wey people dey use scare bird for melon field; dem no fit talk; na carry dem dey carry them because dem no fit waka. Make una no fear them: dem no fit harm una, and dem no fit do una any good.”

6 God, no one be like you; you be mighty God, and your name na great and powerful name.

7 Who no go honour you, king of all nation? You deserve to get honour. No one be like you among the wise men of nation or among their kings.

8 All of them dey stupid and foolish. Wetin dem fit learn from idols wey dem make with wood?

9 Na silver cover their idol from spain and gold cover their idol from Uphaz, all na work of artist; dem dress them with violet and purple cloth and na skilled weaver do am.

10 But LORD, na you be the true God, you be the living God and you be the eternal king. The world dey shake when you dey vex; the nation no fit survive your anger.

11 {Una must tell them say the god wey no make earth and sky go perish. Dem no go dey for anywhere on earth again.}

12 Na God make the earth with him power; he create the world with him wisdom and stretch out heaven.

13 The water wey dey for sky dey make noise when him command; he dey bring cloud from the end of the earth. He dey make lightning to dey flash inside rain and send wind from him storeroom.

14 As people see this, dem dey feel stupid and senseless; those wey make the idols dey discouraged, because the god wey dem make na lie and e no get life.

15 Dem no get value and una suppose hate them; dem go perish when God come deal with them.

16 The God of Jacob no be like them; na him make everything, and he don choose Israel make dem be him own people. Him name na Almighty God.

17 People of Jerusalem, una dey under attack! Make una gather wetin una get together.

18 God go throw una out of this land; he go destroy una until no one of una remain. God don talk.

19 People of Jerusalem cry out say, “We dey suffer great pain! Our wound no dey heal. And we think say na something wey we fit survive!

20 Our tent don destroy; the rope wey hold them don break. All our children don go away; nobody dey wey fit raise our tent again; nobody dey wey fit hang their curtain.”

21 I answer say, “Our leaders dey stupid; dem no ask God to guide them. Na why dem fail be this, and our people don scatter.

22 Listen! News don come! Trouble dey for the nation wey dey north; hin army go turn cities of Judah to desert, a place where fox dey live.”

23 God, I know say nobody be master of him own destiny; no person get control over him life.

24 God, correct your people; but make you no dey hard on us or punish us when you dey vex; na that go be our end.

25 Turn your anger on the nation wey no worship you and on top people wey reject you. Dem don kill your people; dem don destroy us completely and destroy our country.

Open Bible reader