Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 65
1 God talk say, I don dey ready to answer my people prayer before, but dem no pray. I don dey ready for them make dem find me before, but dem no even try find me. The nation no pray to me, even though I dey always dey ready to answer them, I dey hear I go help una
2 I don always dey ready to welcome my people, wey dey use strong head to do wetin dey wrong and go their own way.
3 Dem continue to dey make me vex without shame. Dem offer pagan sacrifice for holy garden and dem burn incense on top pagan altar.
4 For night dem dey go follow spirit of the dead for caves and tombs. Dem chop pork and drink broth wey dem make from meat wey dem offer for pagan sacrifice.
5 And dem then tell others say, Make una go away from us; we dey too holy pass wetin una fit touch! I no fit stand people like that- my anger against them be like fire wey no dey die.
6 I don already decide on their punishment, and I don write their sentence. I no go overlook wetin dem don do, but I go repay them
7 Fot their sin and for sin of their ancestors. Dem don burn incense for pagan hill shrine and dem don speak evil about me. So I go punish them for wetin dem don do before.
8 God talk say, Nobody dey destroy good grapes; instead, dem dey use them make wine. Naso I no go destroy all my people- I go use those wey serve me.
9 I go bless the Israelite wey belong to the tribe of Judah, and their descendant go possess my land on mountain. My people, wey serve me, go live for there.
1 Dem go worship me and I go lead their sheep and cattle go field for plain of Sharon for west and for Valley of Trouble for east.
1 But e go dey different for una wey, wey ignore Zion, my holy hill to reject me, and go dey worship Gad and Meni, god of luck and fate.
1 Na una fate e go be to die terrible death, because una no answer when I call una or listen when I speak. Una choose to disobey me and to dey do evil.
1 And so I tell una say those wey worship and obey me go get plenty to chop and drink, but una go dey hungry and thirsty. Dem go dey happy, but shame go catch una.
1 Dem go sing for joy, but una go cry with broken heart.
1 My chosen people go use una name as curse. I, the Almighty LORD, go kill una. But I go give those wey obey me new name.
1 Na faithful God go bless anyone in the land wey ask for blessing. Anyone wey take oath go swear by name of faithful God. The trouble of the past go be forgotten.
1 God talk say, I dey make new earth and heaven. Una go forget wetin don happen for past completely.
1 Make una dey glad and happy in wetin I create forever. Joy go full the new Jerusalem wey I make, and him people go dey happy.
1 Joy go fill me too because of Jerusalem and him people. Crying no go dey there, no calling for help.
2 Pikins no go die for small again, and all people go live there normal full life time. People go see those wey live reach hundred as young. To die before that go be sign say I don punish them
2 People go build houses and dem go live for inside them themselves, another person no go use them. Dem go plant vineyards and dem go enjoy the wine- others no go drink am.
2 My people go live long lives, like trees. Dem go fully enjoy the things wey dem don work for.
2 The work wey dem do go dey successful, and trouble no go meet their children. I go bless them and their descendant for all time to come.
2 Even before them finish to dey pray to me, I go answer their prayers.
2 Wolves and lamb go chop together, lions go chop straw, like cattle dey chop, and snake no go dey dangerous again. Anything harmful or evil, no go dey for Zion, my holy hill.