Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Isaiah 54

1 Jerusalem, una don dey like woman wey no get pikin, but now una fit sing and shout for joy. Now una go get plenty children pass a woman wey him husband never leave her!

2 Make the tent wey una dey live dey large, make the length of the rope long and make una allow the peg dey strong!

3 Una go expand una boundary for all side; una people go get back the land wey other nations dey occupy now. People go full the cities wey dey empty now.

4 Make una no fear-una no go dey dissapointed; people no go say bad thing against una, wey una dey young una dey for shame, but una go forget that shame now, una no go remember the shame wey una feel when una lose una husband

5 Una creator go dey like husband to una- na the LORD Almighty be him name. the holy God of Israel go save una- na him be the ruler of all the world.

6 Israel, una be like young wife, wey dey for pain wey hin husband don leave. But God call una back to him and talk say:

7 “For one moment I don leave una; na with deep love I go take una back.

8 Na only a moment I turn away in angry, but I go show una my love forever.” Naso the LORD wey save una talk.

9 “I don promise in the time of Noah say I no go flood the earth again. Now I don promise say I no go ever vex with una again; I no go rebuke or punish una.

1 Mountains and hills fit fall, but my love for una no go end; I go keep my promise of peace for ever.” Naso the LORD wey care for una talk.

1 God talk say, “O Jerusalem, city wey dey suffer and dey helpless, wey no get anybody to comfort am, I go rebuild una foundation with precious stones.

1 I go build una tower with rubies, I go build una gate with stones wey shine like fire, and I go build the wall around una with jewels.

1 “I go teach una people myself and I give them prosperity and peace.

1 Justice and right go make una strong. Una go dey save from oppression and fear.

1 Anyone wey attack una go do am when I no know; anyone wey fight against una go fail.

1 “Na me create the blacksmith wey build fire and make weapons. Na me also create soldiers wey dey use weapon to kill.

1 But no weapon go fit hurt una; una go answer for all wey accuse una. I go defend my servants and I go give them victory.” God don talk.

Open Bible reader