Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 52
1 Jerusalem, make una dey strong and great again! Holy city of God, make una clothe unaselves with beauty! Pagan no go enter una gate again.
2 Jerusalem make una shake unaselves free,! Make una rise from the dust and sit on top una throne! Make una loose the chain wey bind una, prisoners of Zion!
3 The Almighty God tell him people say, When una become slave, dem no pay money for una;na for the same way, payment no go dey to set una free.
4 When una go dey live for Egypt as prisoners, una do am on una own free will; Assyria, con take una away by force and dem no pay una anything.
5 And now the same thing don happen for Babylonia: una be prisoners and dem no pay una anything. Those wey dey rule una dey boast and brag and dem dey always disrespect me.
6 Very soon una go accept say I be God and I don speak to una.
7 E go dey beautiful to see a messenger dey come across mountains, dey bring good news, news of peace! He con announce victory and tell Zion say, Una God na king!
8 Those wey guard the city dey shout, dem dey shout together with peace! Dem fit see return of God of zion with their own eyes!
9 Make una begin dey shout for joy, una wey remain after Jerusalem don destroy! God go rescue this city and he go comfort him people.
1 God go use him holy power; he go save him people, and all the world go see am
1 Make una dey sure say una leave Babylonia, all of una wey carry Temple equipment! Make una no touch unclean things, make una keep unaselves holy and leave.
1 This time una no go need to rush leave; una no go try to dey escape, the LORD una God go protect una and protect una from every side.
1 God talk say, My servant go succeed for him task; he go receive honour.
1 Shock go catch plenty people when dem see him; he go look ugly so tey he no look like human being again.
1 But now plenty nation go dey surprise about him, and kings go dey speechless with surprise. Dem go see and understand something wey dem no know before.