Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 31
1 Those wey go meet Egypt for help don enter trouble! Dem dey rely on great strength of Egypt military- horse, chariot, and soldiers. But dem no rely on the LORD, the holy God of Israel, or ask am for help.
2 He know wetin he dey do! He dey send disaster. He dey carry out him threat to punish evil people and those wey dey protect them.
3 Egyptians no be gods- na human dem be. Their horses no be supernatural. When God act, strong nation go fall, and weak nation wey e help go fall. Both of them go destroy.
4 God tell me say, No matter how shepherd dey shout, dem no fit pursue lion commot from animal wey e don kill; for same way, nothing fit keep me, the LORD Almighty, say make I no protect Mount Zion.
5 Just as bird dey hang on top hin nest to protect hin pikin, naso I, the LORD Amighty, go protect Jerusalem and defend am.
6 God talk say, People of Israel, una don sin against me and go against me. But now, make una come back to me!
7 A time dey come when all of una go throway the sinful idols wey una make out of silver and gold.
8 Na war go destroy Assyria, no be human power. The Assyrians go run from battle, and their young men go turn to slave.
9 Their emperor go run away in fear, and fear go catch the officers so tey dem go even abandon their battle flags. God don talk= god wey Jerusalem dey worship and wey fire dey burn there for sacrifice.