Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 30
1 God don talk say: Those wey dey rule Judah don enter trouble because dem rebel against me. Dem follow the plan wey I no make, and dem sign agreement against my will, dem dey pile one sin on top another.
2 Dem go to Egypt for help and dem no ask for my advice. Dem want make Egypt protect them, so dem put their trust in Egypt king.
3 But the king no get power to help them, and na trouble go end Egypt protection.
4 Although their ambassadors don already arrive for Egyptian city of Zoan and Hanes,
5 People of Judah go regret say dem do ever trust that nation wey no dey reliable, nation wey fail them when dem need help.
6 Na message of God about the animal wey dey southern desert be this: The ambassadors don travel through dangerous country, where lions dey live and where poisonous snake and flying dragon dey. Dem load their donkey and camel with expensive gift for nation wey no fit give them any help.
7 The help wey Egypt dey give dey useless, na so I give Egypt nickname, Harmless Dragon.
8 God tell me say make I write down wetin the people be for book, so that permanent record of how evil dem be go dey.
9 Dem dey always go against God, dem dey always dey lie, always refuse to dey listen to teaching of God.
1 Dem tell prophet say make he keep quiet. Dem talk say, Make una no talk to us about wetin dey right. Make una tell us wetin we wan hear. Allow us make we keep our dream.
1 Make una commot from our way and make una stop to dey block our way. We no wan hear about your holy God of Israel.
1 But na wetin holy God of Israel talk be this: Una know follow wetin I tell una and una rely on violence and deceit.
1 Una dey guilty. Una be like high wall wey get crack around am; suddenly una go collapse.
1 Una go scatter like clay pot, una go break to pieces so tey big size no go dey wey person fit use carry hot coal, or wey person fit use take water from tank.
1 The sovereign LORD, holy God of Israel, tell the people say, Make una come back and trust in me. Then una go dey strong and secure. Bnt una no gree do am!
1 Instead, una plan to escape from una enemy say una go ride fast horse. And una dey right- na to escape be the right thing wey una suppose do! Una think say una horse dey fast enough, but those wey dey pursue una go fast pass una!
1 Thousand of una go run away when una see one enemy soldier, five soldiers don dey enough to make all of una run away. Nothing go remain for una army except flagstaff on top of the hill!
1 And yet God dey wait to dey merciful to una. He dey ready to get pity on una because he dey always do wetin dey right. Happy are those wey put their trust in God.
1 Una people wey dey live for Jerusalem no go cry again. God dey caring, and when una cry to him for help, he go answer una.
2 God go make una go through hard time, but he go dey there to teach una by himself, and una no go need to dey look for him again.
2 If una dey miss road go right and left, una go hear sound for una back wey go dey talk say, Na the road be this. follow am.
2 Una go take una idols wey una cover with silver and una idols wey dey cover with gold, and una go throw am away like dirty, and dey shout say, Commot for my sight!
2 Anytime una plant una seed, God go send rain to make them grow and he go give una rich harvest, and una livestock go get plenty grassland.
2 The bull and donkey wey dey work for una field go chop the finest and best food.
2 On that day when dem capture una enemy wall, and dem don kill their people, stream of water go flow from every mountain and hill.
2 The moon go dey bright like sun, and the sun go be seven time hot pass normal, e go be like light of seven days in one. All this go happen when God put bandage and heal the wound wey he don give him people.
2 From distance everyone go fit see the power and glory of God. Fire and smoke dey show him anger. He dey talk, and him word dey burn like fire.
2 He dey send wind go him front like flood wey throway everything . E dey sweep nation to destruction and end their evil plans.
2 But una, people of God, go dey happy and una go sing as una do for night of holy festival. Una go dey happy like those wey waka go music flute on their way go Temple of God, the defender of Israel.
3 God go allow everybody hear him great voice and feel force of him anger. There go be flames, cloudbursts, hailstones, and heavy rain.
3 The Assyrian go fear when them hear voice of God and dem go feel the force of him punishment.
3 As God dey strike them again and again, him people go keep time with music of drum and harps. God himself go fight against Assyrians.
3 E don tey wey dem don prepare place where fire go burn emperor of Assyria. E dey deep and wide, and plenty wood full am. God go con breathe out stream of flame to set am on fire.