Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Isaiah 26

1 A day dey come when the people go sing this song for the land of Judah: our city dey strong! Na God himself dey defend the walls!

2 Make una open the city gate and make una allow the faithful nation enter, the nation wey hin people dey do wetin dey right.

3 LORD, you dey give perfect peace to those wey keep their purpose very well and those wey put their trust in you.

4 Make una trust in God for ever; he go always protect us.

5 .He don humble those wey dey proud; he don destroy the strong city where dem dey live, and he don crash hin walls to dust.

6 Then poor and humble people go waka on top am and dem match am under their feet.

7 God, na you dey make path smooth for good people; the road wey dem dey travel dey smooth.

8 We dey follow your will and we dey put our hope in you; na you be everything wey we want.

9 With all my heart I dey long for you all night; when you judge the earth and hin people, all of them go know wetin justice be.

1 Even though say you dey kind to the wicked, dem never learn wetin dey right. Even in the land of righteous people here, dem still dey do wrong; dem no gree accept your greatness.

1 Your enemies no know say you go punish them. LORD, make you put them to shame and allow them suffer; allow them suffer the punishment wey you don prepare. Make you con show them how much love you people.

1 God, you go make us prosper; everything wey we achieve na the result of wetin you don do.

1 LORD our God, other don rule us before, but na only you be our LORD.

1 Now dem don die and dem no go live again; their ghost no go rise, because you don punish them and destroy them. No one dey remember them again.

1 God, you don make our nation grow, you don enlarge hin territory for every side, and this don bring honour to you.

1 God, you don punish your people, and dem don pray to you in pain.

1 LORD, you don make us cry out, like woman wey dey for labour dey cry out in pain.

1 We been dey pain and agony, but we no give birth to anything. We never win victory for our land; we never achieve anything.

1 our people wey don die go live again! Their body go con come back to life. All those wey dey sleep in their grave go wake up and sing for joy. As dew dey refresh the earth, naso God go revive those wey don for long.

2 My people, make una go to una houses, and close the door . Make una hide unaselves for small time until God stop to dey vex.

2 God dey come from him heavenly place to punish the people of the earth of their sin. The killing wey dem do for secret on earth go open, and ground no go hide those wey dem don kill again.

Open Bible reader