Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Isaiah 18

1 E get a Land wey dey after river of Ethiopia where dem dey hear the sound of the wings.

2 Ambassadors con come down through Nile from that land with boat wey dem make with reeds. Make una go back home, fast messengers! Make una take message back to una land wey rivers divide am, make una take am go una strong and powerful nation, go una tall people wey get smooth-skin, wey the whole world dey fear.

3 Make una listen, everyone wey dey live on earth! Make una look for sign wey I go raise on top the mountains! Make una listen as I go blow trumpet!

4 God tell me say, “I go look down from heaven quietly just as due dey form for warm night of harvest time, as calm as sun dey shine for the heat of the day.

5 When all the flower don fall and the grapes dey ripe, before dem gather the grapes, the enemies go destroy Ethiopia easily like knife dey cut branches from vine.

6 Dead body of their soldiers go dey for ground for bird and wild animals. The birds go chop them for summer, and animals go chop them for winter.”

7 Time dey come when Almighty God go receive offering from this land wey rivers divide, from this strong and nation wey get power, from this tall and people wey get smooth skin, wey people dey fear all over the world. Dem go come mount Zion, where dem dey worship Almighty God.

Open Bible reader