Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 16
1 People of Moab dey send lamb as present to the one wey dey rule for Jerusalem from city of Selain for inside desert.
2 Dem wait for the edge of River Amon and dem dey waka up and down, like bird wey person dey pursue commot from their nest.
3 Dem tell people of Judah say, Make una tell us wetin to do. Make una protect us like trees wey dey give cool shadow for heat of noon, and make una allow us make we rest for una shade. We be be people wey escape war; make una hide us where no one find see us.
4 Make una allow us stay for una land. Make una protect us from those wey wan destroy us. {oppression and destruction go end, and those wey dey destroy the land go leave.
5 Then one of the descendant of David go be king, and he go con rule the people with faithfulness and love. He go dey quick to dey do wetin dey right, and he go dey sure say justice dey the land.}
6 People of Judah talk say, We don hear how proud people of Moab be. We know shey dem dey arrogant and dem dey brag, but there brag na empty brag.
7 People of Moab go cry because of the trouble wey dem suffer. All of them go cry when dem remember the kind fine food wey dem use to dey chop for the city of Kir Heres. Dem go dey hopeless.
8 The farm wey dey near Heshbon and the vineyard of sibman don destroy- those vineyard wey the wine dey always make the ruler of the nation high. At a time the vines spread go far reach city of Jazer, and eastward go desert, and westward go the other side of the Dead Sea.
9 Now I dey cry for vine of Sibmah as I dey cry for Jazer, my tears dey fall for Heshbon and Elealeh, because harvest no dey wey go make the people happy.
10 No one dey happy for the good land now. No onme dey shout or sing for the vineyards, no one dey press grape to make wine; the shout of joy don end.
11 I dey cry with sadness for Moab, I dey cry with sorrow for Kir Heres.
12 People of Moab dey disturb themselves to dey go their mountain shrines and to dey go their temple to dey go pray, but e no go do them any good.
13 Na the message wey God give about Moab be that.
14 And now God talk say, In exactly three years great wealth of Moab go disappear. Out of hin plenty people na only small go survive, and dem go dey weak.