Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Isaiah 11

1 The royal line of David be like tree wey dem don cut down; but just as new branches dey grow , naso new king go rise from among descendant of David.

2 The spirit of God go give him wisdom, and the knowledge and skill wey he go use rule him people. He go know the will of God and he go honour him,

3 And he go find pleasure to dey obey. He no go judge with appearance or things wey people talk;

4 He go judge the people fairly and he go defend the right of helpless. Wen he command people go be punished, and evil people go die.

5 He go rule him people with justice and integrity.

6 Wolves and sheep go live together in peace, and leopard go lie down with goats. Calves and lion cubs go dey chop together, and little pikin go dey take care of them.

7 Cows and bears go chop together, and their calves and cubs go lie down in peace. Lions go dey chop grass as cattle dey do.

8 Even if pikin place near poisonous snake e no go harm the pikin.

9 Nothing harmful or evil go dey Zion, the holy hill of God. The land go dey full of knowledge of God as sea dey dey full for water.

10 A day dey come when the new king from royal line of David go be symbol to the nation. Dem go gather for him royal city and dem go con con give am honour.

11 When that day show, God go use him power once again and bring back home him people wey remain for Assyria and Egypt, for the land of Pathros, Ethiopia, Elam, Babylonia, and Hamath, and for the coastlands and island of the sea.

12 God go raise signal flag to show nation say he dey gather together again the people of Israel and Judah wey don scatter and dey bring them back from the four corners of the earth.

13 The kingdom of Israel no go dey jealous of Judah again, and Judah no go be enemy of Israel.

14 Dem go attack the philistine together from the west and dem go rob the people wey dey live for the east. Dem go conquer the people of Edom and Moab, and people of Ammon go obey them.

15 God go dry up the Golf of Suez, and he go bring hot wind make e dry up the Euphrates, and he go leave only seven tiny stream, so that everyone go fit waka across.

16 Highway go dey out of Assyria for those of him people Israel wey don survive for there, just as e dey for their ancestor when dem commot for Egypt.

Open Bible reader