Nigerian Pidgin Bible
Hosea 11
1 God talk say, when Israel be pikin, I love him and call him out of Egypt as my son.
2 But the more I dey call him, na the more he dey turn away from me. My people sacrifice for Baal; and them burn incense for idols.
3 Yet na me teach Israel how to dey waka. I take my people up for arm, but dem no respect say I take care of them.
4 I draw them close to me with affection and love. I pick them up and hold them for my cheek; I bend down for them and I feed them.
5 "Dem no gree return to me, so them must return go Egypt, and Assyria go rule them.
6 War go wipe through their city and go break down the city gate. E go destroy my people because dem do wetin them think say na the best.
7 Them insist to turn away from me. Them go cry out because of the yoke wey dey on them, but no one go commot am from them.
8 "How I fit give up, Israel? How I fit abandon una? Shey I fit destroy una as I do for Admah, or treat una as I do Zeboiim? My heart no go allow me do am! My love for una strong.
9 I no go use my anger punish una; I no go destroy Israel again. Because I be God and no be human being. I, the holy one, dey with una. I no go come to una in anger.
10 "My people go follow me when I shout like lion to their enemy. Dem go run to me from west.
11 Dem go come fast from Egypt, like bird, and from Assyria, like dove. I go bring them come their home again. I, the LORD, don talk."
12 God talk say, "People of Israel don surround me with lie and deceit, and people of Judah still dey rebel against me, the faithful and holy God.