Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Genesis 6

1 People come dey multiply on top earth and dem dey born daughters.

2 Sons of God come see say daughters of men dey beautiful and dem fine, they come begin dey marry them as dem like.

3 God come say, "My Spirit no go dey with human for that long time because dem get sinful flesh. For future, them no go dey live pass 120 years on top earth.

4 For those days and even later, any time wey son of God make love to women, dem dey born pikin wey dey turn hero and warrior of old time.

5 When God see how wicked people be for earth, and how dem dey always think of bad things,

6 God come begin to dey regret say na Him create them.

7 God come say I go destroy human wey I don create comot from the face of earth and I go destroy every living things, big animals, small animals wey dey crawl for ground and even birds wey dey for sky, I regret say I make them.

8 But Noah get favour and grace from God.

9 Na the account of Noah and him family be this. Noah na righteous man and na him be the only person wey no get blame on top earth that time and him dey close to God.

10 Noah na the father of Shem, Ham, and Japhet.

11 God see say earth don spoil and e dey full of trouble.

12 God begin dey watch bad things wey dey on top earth because everybody don spoil.

13 God tell Noah say I don decide to destroy all human beings because dem don full earth with trouble and I go destroy them completely.

14 Build a boat with good wood, make rooms inside am and use tar cover am inside-out.

15 Build boat wey be 450 feet long and 75 feet wide and 45 feet high.

16 Make roof on top the boat and leave eighteen inches space under the roof all round the boat, put door for the side and make the boat get three levels, lower, middle and upper level.

17 I go send flood wey go destroy every living things on earth, everything wey dey earth go die.

18 But, I go keep my covenant with you. Enter boat with your wife, your sons and their wives.

19 Take male and female of all kain animals enter inside boat with you so that them go dey alive during flood.

20 Male and female of all kind animals go come to you so that dem go dey alive.

21 And make sure say you take enough food for your family and for all animals.

22 Naso Noah do everything wey God don command him.

Open Bible reader