Nigerian Pidgin Bible
Genesis 35
1 God con tell Jacob say, "Begin dey go Bethel make you go settle there, make you build altar to me, God wey appear to you when you dey run from your brother Esau."
2 Jacob con tell him family and the people wey dey with him say, "Make una drop the idols wey dey with una, purify yourselves and make una wear clean clothes.
3 We dey go Bethel where I go build altar to God wey help me for the time when I dey for trouble, and wey don dey with me everywhere wey I don go."
4 Naso dem give Jacob all the idols wey dem get and all the earings wey dem dey wear. He come burry them under oak tree wey dey near Shechem.
5 When Jacob and him sons start to dey go, people wey dey live for towns wey dey near them begin dey fear and dem no pursue them.
6 Jacob and him people come reach Luz wey dem dey call Bethel for Cannan land.
7 He come build altar for there and he call am El-Bethel, because na there God show himself to him when he dey run from him brother.
8 Deborah wey be Rebecca nurse con die, dem con burry her under oak tree wey dey south of Bethel. Naso dem name the place oak of weeping.
9 When Jacob con return from Mesopotamia, God con appear to him again and bless him.
10 God come tell am say, "Your name na Jacob, but from now on, na Israel you go be. Naso God name am Israel.
11 God con tell am say, "Na me be Almighty God, begin dey get many children and dey increase in mumber, nations go descend from you and you go be ancestor of kings.
12 I go give you the land wey I give Abraham and Isaac and I go also give am to your descendant after you.
13 God come leave him.
14 Jacob come use stone pillars to mark the place wey God don follow him talk. He come pour wine on top am as offering to God and he anoint am with olive oil.
15 Jacob con name the place Bethel wey mean house of God because God don talk to him for there.
16 Jacob and him family come dey leave Bethel and as dem don dey close to Ephrath, time come reach for Rachael to born.
17 and she con dey get problem when she wan born. When the pain don too much, the midwife con tell her, "Rachael no fear, na another boy." But Rachael don almost die.
18 She come use her last breath name the baby Benoni but him father name am Benjamin.
19 When Rachael die, dem burry her by the road wey go to Ephrath wey dem dey call Bethlehem now.
20 Jacob come set memorial stone for there, and e still mark Rachael grave till now.
21 Jacob come continue to dey go and he build camp for the other side of Edar tower.
22 When Jacob still dey live for that land, Reuben come make love with Bilhah, one of him father concubines. Jacob come hear about am and he begin dey vex.
23 Jacob get twelve sons, Leah sons na Reuben the eldest son, Simeon, Levi, Judah, Issachar and Zebulun.
24 Rachael sons na Joseph and Benjamin.
25 Son of Rachael slave Bilhah na Dan and Naphtali.
26 Son of Leah slave Zilpah na Gad and Asher. Na Mesopotamia them born these sons.
27 Jacob come go meet him father for Mamre wey dey near Hebron wey Abraham and Isaac don live.
28 Isaac live for one hundred and eighty years,
29 he come die for old age and him sons Esau and Jacob burry am.