Nigerian Pidgin Bible
Genesis 23
1 When Sarah reach 127 years old,
2 She die for Hebron in Canaan land, and Abraham mourn and cry for her death.
3 He con live the place wey him wife body dey , he go meet the Hittites, and he say to them,
4 "I be foreigner wey dey live among you, abeg sell some land for me so that I go fit bury my wife.
5 Dem come answer,
6 Hear us sir, we dey look you as mighty leader, go bury your wife for the best grave wey we get, any of us go dey happy to give you a grave so that you go fit bury your wife. 7Abraham come bow down before them and he say,
8 "If you want make I burry my wife here, help me ask Ephron, son of Zohar, make he sell Machpelah Cave, wey dey near to the edge of him field to me. Ask him make he sell am to me for full price for una presence, so that I fit get am as my own burial ground."
9 -
10 Ephron himself dey sit with other Hittites at the meeting place for city gate; he come answer in front of everybody,
11 Hear me sir, I go give you the whole field and the cave wey dey inside am. For where my own people dey, I go give am to you, so that you go fit bury your wife.
12 But Abraham bow down before Hittites
13 and he say to Ephron so that everyone go fit hear, "Abeg hear me, I go buy the whole field. Accept my payment, and I go bury my wife there."
14 Ephron come answer,
15 "Sir, the land na just 400 pieces of silver - wetin that one be between us? Bury your wife there".
16 Abraham come agree and he pay the amount wey Ephron don mention for the presence of people " 400 pieces of silver, according to standard wey merchant dey use.
17 Naso the property wey belong to Ephron for Machpelah, east of Mamre come turn to Abraham own. The property include, the field, the cave wey dey inside am, and all the trees wey dey inside the field.
18 All Hittites wey dey the meeting recognize am as Abraham property.
19 Abraham come bury him wife, Sarah, for the caf" wey dey the land of Canaan.
20 Naso the field wey belong to Hittites, and the cave wey dey inside become property of Abraham for burial ground.