Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Galatians 6

1 My brodas and sistas, if una si pesin dey sin, mak una wey dey spiritual, kol am bak. Bot mak una wosh unasef, so dat una nor go fal insaid temtashon tu.

2 Mak una help kari ish oda load and if una du laik dis, una dey obey Kraist.

3 Bikos if enibodi tink sey, en tu big wen e nor bi enitin, e dey disiv ensef.

4 Mak evribodi shek ensef, den e go fit tok abaut ensef, insted of am to dey kompare ensef wit anoda pesin.

5 Bikos ish pesin go kari en own load by ensef.

6 Di pesin wey dem dey tish God wod, must share di gud tins wey e get wit di pesin wey dey tish am.

7 Mak una nor let enibodi disiv una. Nobodi go fit disiv God. Enitin wey pesin plant, naim e go reap,

8 bikos di pesin wey dey liv akordin to en flesh, go reap bad tins, bot di pesin wey dey liv akordin to God Spirit, go reap life wey nor dey end.

9 So mak to du gud, nor taya us, bikos wen taim rish, wi go gain am.

10 So enitaim wey wi get shanse, mak wi dey du gud, especiali to pipol wey bi God shildren.

11 Mak una si as di wod wey I tak my hand rite giv una, big rish!

12 Pipol wey won show sey dem gud, dey trai to fos una to sekonsaiz. Dem dey du so, so dat dem nor go sofa, bikos of Kraist kros.

13 Pipol wey sekonsaiz nor dey obey di law, bot dem wont mak una sekonsaiz, so dat dem go fit yuz una tak boast.

14 I nor go boast abaut enitin esept for di sofa wey awa Oga Jisos Kraist sofa and bikos of dat sofa, di wold nor min enitin to mi and I don die to di wold tu.

15 Weda pesin sekonsaiz or not, e nor min enitin, di onli tin wey mata bi sey, una don turn to new pesin.

16 Una wey dey obey dis rule wey I dey giv so, mak peace and mesi dey wit una and all God pipol.

17 From naw go, mak nobodi wori mi, bikos I get Jisos Kraist mark for my bodi.

18 My brodas and sistas, mak awa Oga Jisos Kraist grace dey wit una spirit. Amen!

Open Bible reader