Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ezekiel 7

1 God follow me talk.

2 "He talk say, "Son of man", "This na wetin I, The Almighty God, dey tell the land of Israel: This na end for the whole land!

3 "Israel the end don come. Una go feel my anger, because I dey judge una for wetin una don do. I go pay una back for every bad thing wey una don do.

4 I no go keep una or show mercy on top una. I go punish una for the bad things wey una don do, so una go know say I be God."

5 Na wetin Almighty God talk be this, "One problem after another dey come on top una.

6 Na the end be this, E don finish. E don finish for una.

7 The end dey come for una wey dey live for the land. The time don near wey celebration for mountain shrine no go dey again, but confusion.

8 "Very soon una go fear the forces of my anger. I dey judge una for wetin una don do, and I go pay una back for every bad things wey una don do.

9 I no go keep una or show una any mercy. I go punish una for the bad things wey una don do, so that una go know say I be God, and una go know say na me punish una."

10 The day of trouble dey come for Israel, injustice and arrogance dey everywhere.

11 violence dey produce plenty wickedness, everything wey dem get no go remain; their wealth, their light, even their glory.

12 The time dey come. The day don near when buy and selling no go get meaning, because God go punish everyone for same way.

13 And people wey dey sell property no go get am back, because I go punish all una for your sin and I no go change my mind!

14 The trumpet don sound and everyone don ready. But no one go fit go war, because for same way the anger of God go come on top everyone.

15 War, disease, and hungry dey for everywhere! People wey dey live for countryside go die for battle, and those wey dey live for town go die for hunger or terrible diseases.

16 Anyone wey survive go escape go hill like dove wey commot for valley go find safe place. All of una go cry because of una sin.

17 Everyone go weak and their knees go shake.

18 Dem go wear sackcloth, all of them go dey shake. Dem go shave their head, and shame go catch them.

19 Dem go throw their gold and silver away for street like something wey no get value, because the gold or silver no fit safe them when God dey vex. Dem no fit use am take satisfy their desire or fit use am take fill their belle. Na gold and silver make dem dey sin.

20 Una dey proud of una beautiful jewel take make rubbish idol of foreign god, so I go make una jewellery no get meaning.

21 Wicked foreigner go rob and disgrace una.

22 I no go do anything when robbers destroy my temple and make am place wey una no fit worship me.

23 Una country dey for confusion, murder and violence dey for everywhere for Israel.

24 So I go tell the most wicked nation make dem con take over una home, dem go end the pride wey una get on una strong army, and dem go destroy una place of worship.

25 Una go shake with fear, una go look for peace and una no go see.

26 Una go dey hear one sad story after the other. Na only bad news una go dey hear. Una go look for prophet and ask for vision, the priest no go get anything to teach una, and the elders no go get any good advice to give una.

27 Even una king and him official go lose hope and cry. Una hands go dey shake with fear. I go punish una for una sin and I go treat una as una don treat others, and una go know say I be God.

Open Bible reader