Nigerian Pidgin Bible
Ezekiel 6
1 God follow me talk.
2 He talk say, "Son of man, look mountain of Israel make you give dem my message.
3 Tell the mountain of Israel make e hear the word of God- make e hear wetin I, The Almighty God, dey tell the mountain, the hills, the rivers, and the valley: I go destroy the place where people dey worship idols.
4 The alter go be broken and the incense alter go be destroy. All people wey dey there go die in front of their idol.
5 I go scatter dead body of people of Israel; I go scatter their body round the alter.
6 All the city of Israel go destroy, so that all their alter and idols go destroy to pieces., I go scatter their incense alter, and everything wey dem make go disappear.
7 People go die for everywhere and those wey remain go know say I be God.
8 "I go allow some people make dem escape and I go scatter dem among nation,
9 where dem go live for other country. Dem go remember me and know say I don punish and disgrace them, because their heart no want me and dem like idols pass me. And dem go hate themselves because of the evil and bad things wey dem don do.
10 Dem go know say I be God and say my warning no be fake."
11 Almighty God talk say, clap your hand! Stamp your feet! Cry in sorrow because of the evil and disgusting things wey people of Israel don do. Dem go die for war by hunger and by disease.
12 Those wey dey far go sick and die; those wey dey near go die for war; those wey survive go die by hunger. Dem go feel all the forces of my anger.
13 I go scatter dead body among the idols and round the alter, and scatter them on top every high hill, on top every mountain, under every green tree and every large oak, for every places wey dem burn sacrifice give their idols. And then everyone go know say I be God.
14 Yes, I go stretch my hand and I go destroy their county. I go waste am from southern desert go the city of Riblah for north, I no go leave any place where Israel people dey live. Then everyone go know say I be God."