Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ezekiel 39

1 Ezekiel, Son of man, condemn Gog and tell am say: you be the ruler of Meshach and Tubal, but I, God, be your enemy!

2 I go turn you around and I go drag you from north until you reach mountain of Israel.

3 I go knock bow commot for your left hand and arrow commot for your right hand,

4 and you and your army go die on top those mountains. And then birds and wild animal go chop flesh

5 of their dead body wey dey lie for open field, I, God, don speak.

6 I go set land of Magog on fire and to those nations wey dey along seacoast, wey dey think say dem safe, and dem go know say I be God.

7 My people Israel go know me, and dem no go disgrace my holy name again. Everyone on earth go know say I be the holy LORD God of Israel.

8 The day wey these things go happen dey come, just as I don promise.

9 When that day don come, people in town of Israel go collect weapon from their enemies wey don die. Dem go use these shield, bows, and arrow, spear, and club as firewood, and enough go dey wey go last for seven years.

10 Dem go burn this these weapons instead make dem gather stick or chopping trees down. Naso Israelites go take revenge on those people wey don rob and abuse them. I, God, don speak.

11 After dey don destroy Gog, I go bury him and his army in Israel for traveller valley, wey dey east of Dead sea. The graveyard go large wey be say, e go block way of everyone wey wan pass through the valley, wey dem go come dey call "Valley of God of Army."

12 People of Israel go use seven months to dey bury dead body and to dey clean up their land.

13 Everyone go help with the burial, and dem go receive honour for this on the day when dem see my glory.

14 After the seven months, people go appoint group of men make dem look around for any body wey dem never bury. Una must do this for seven months to make sure say the land no dey unclean again.

15 Whenever dem see human bone, dem go set marker next to am. And den gravedigger go bury am for inside "The valley of Gog Army"

16 near town of "Gog Army." After that, the land go pure again.

17 Ezekiel, son of man, I go hold feast on top mountain of Israel and go offer sacrifice for there. So invite all birds and wild animal make dem come from every direction and chop meat of sacrifice and drink blood. The birds and animal

18 go feast on bodies of warrior and foreign rulers wey I go sacrifice like sheep, goat, and bull.

19 I wan make the bird and wild animal chop until dem bellefull and drink until dem drunk.

20 Dem go come my table and stuff dem self with flesh of horse and different kind warrior. I, God, don speak.

21 When I punish nations wey dey earth, dem go see brightness of my glory.

22 People of Israel go know from then say, I be the LORD their God.

23 Foreign nations go know say, I force Israel commot for their land because dem sin against me. I turn my back for my people and I allow enemy make dem attack and kill them.

24 Their lives wicked and corrupt, and dem deserve to be punished.

25 Now I go show people of Israel mercy and I go bring them come back from the land wey dem dey live. Dem be Jacob descendant, so I go bless them and show dem say I dey holy.

26 Them go live safely for their own land, but dem go shame when dem remember their evil way and how dem don disgrace me.

27 Foreign nations go watch as I take Israelites commot from land of enemy and bring them back home, and those nations go see say I dey holy.

28 My people go know say I, the LORD their God send dem away as prisoners and I go bring them come back their own land.

29 I no go turn my back against people of Israel again, and my spirit go live in them. I, God, don speak.

Open Bible reader