Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ezekiel 38

1 God talk say:

2 Ezekiel, son of man, condemn Gog, that wicked ruler of Kingdoms of Meshach and Tubal for the land of Magog. Tell him say:

3 I, the LORD God, I be your enemy,

4 And I go make you powerless! I go put hook for your jaw and drag you and your plenty army commot. You command cavalry troop wey wear armour and wey carry shield and sword.

5 Your army include soldier wey come from Persia, Ethiopia, and Libya,

6 Even From Gomer and Beth-Togarmah for north. Your army too plenty!

7 So make you keep your troop prepare so dem fit fight,

8 Because small year now, I go command una make una enter Israel, country wey war don destroy. E don empty for time, but people of Israel don return from foreign nation where dem dey live. Israelites dey live in peace on top mountain wey be their own land.

9 But you and your army go attack them like fire thunderstorm and una go surround them like cloud.

10 When that day show, I know say una go get evil plan

11 So una fit take advantage of Israel, wey be weak and peaceful country where people dey live safely for inside town wey no get wall or gate wey dey fit lock.

12 Una go rob people wey dey town wey be pile of rubble before. This people be like prisoners for foreign country, but dey return go Israel, wey be most important place in the world, and dem get livestock and property wey your army carry commot from Israel.

13 People of Sheba and Dedan, along with sellers from village for southern Spain for be una allies. Dem go need some of una silver and gold, as well as livestock and property wey una army don take away from Israel

14 I, the LORD God, know say, when you go see my people of Israel dey live in peace,

15 You go lead una powerful cavalry from your kingdom wey dey north.

16 Una go attack my people like storm-cloud wey cover their land. I go allow una enter my country Israel, so every nation on earth go know say I, be God, and I dey holy.

17 God tell Gog say: e don tey wey I order my prophet make dem warn people of Israel say, someday I go send enemy make dem come attack una. You, Gog, na the enemy, and that day dey come.

18 When una enter Israel, I go vex,

19 And as I dey vex, I go send terrible earthquake make e shake Israel.

20 Every living things on earth go shake dey fear me " every fish and bird, every wild animal and reptile, and every human. Mountain go break, cliff go fall, and cities go collapse.

21 I, God, go make mountain of Israel turn against una. Una troop go fear than them go dey attack each other.

22 I go strike una with disease and I go use death punish una. I go pound you and your with rainstorm, hailstone, and burning Sulphur.

23 I go do these things to show the world say I, God, I be holy.

Open Bible reader