Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ezekiel 35

1 God tell me.

2 He talk say, "Son of man", "Speak against country of Edom.

3 Tell the people wetin I, the Almighty God, dey say: "I be una enemy, mountain of Edom! I go make una empty wasteland.

4 I go destroy una city and I go empty una land; then una go know say I be God.

5 "Why? Because una always dey against my people. Una use una sword against Israel in the time wey them dey trouble, for the of their final punishment."

6 So then- as surely as I, the Almighty LORD, be the living God- death na una fate, and una no fit escape am. Una dey guilty of killing, and killing go follow una.

7 I go waste the hill country of Edom and I go kill everyone wey travel through am.

8 I go use dead body cover the mountain, and the bodies of those wey die for battle go cover the hills and valley.

9 I go empty una for ever, and no one go live for una city again. Then una go know say I be God.

10 "Una talk say the two nations, Judah and Israel with their land, belong to una and una talk say na una get am, even though I, the LORD, be their God.

11 So then, as surely as I, the Almighty LORD, be the living God, I go pay una back for una anger, una jealous, and as una hate my people. Dem go know say I dey punish una for wetin una don do to dem.

12 Then una go know say I, God, hear una dey talk say mountain of Israel don empty and una talk say una dey wait to swallow am up.

13 I hear wild and boastful way una dey talk against me."

14 The Almighty God talk say, I go empty una wey be say all the world go rejoice to una downfall,

15 Una happy as country of Israel don destroy. Na the same way na in I go treat una. Mount sier and all country of Edom go destroy. Then una go know say I be God."

Open Bible reader