Nigerian Pidgin Bible
Ezekiel 26
1 God speak to me, on the first day of the" month of eleventh year wey we dey foreign land.
2 He talk say, "Son of man", "this na wetin people of Tyre dey cheer about. Them shout say, "Jerusalem don shatter! Her commercial power don go! She no go be our rival again!"
3 "Now then, this na wetin I, the Almighty God dey say: City of Tyre, I be your enemy. I go bring many nation make dem come attack you, and dem go come like waves of sea.
4 Dem go destroy una city wall and tear down una tower. Then I go sweep the dust commot and I go leave only the bare rock.
5 Fishermen go dry their net on top am, there where e dey stand for sea. I, the Almighty God don speak. The nation go destroy Tyre,
6 and them go use their sword kill those people wey dey live for her town on top mainland. Then Tyre go know say I be God."
7 The Almighty God talk say, "I go bring the great king of all- king Nebuchadnezzar of Babylonia- to attack Tyre. He go come from north with plenty army, with horses and chariot and with cavalry.
8 Those wey dey live in the town on mainland go die in the fighting. The enemy go dig hole, build earthwork, and make solid wall of shield against una.
9 Dem go make pound for una wall with battering rams and tear una tower down with iron bar.
10 The cloud of dust raise by their raise go cover una. The noise of their horses pulling wagon and chariot go shake una wall as dem pass through the gate of the city wey don destroy.
11 Their horsemen go go through una street, killing una people with their sword. Una mighty pillar go be thrown for ground.
12 una enemy go help themselves to una wealth and una things wey una wan sell. Dem go pull down una wall and shatter una pleasant houses. Them go take the wood and stone and all the rubble, and throw dem for inside sea.
13 I go put end to all una songs, and I go silence song of una harp.
14 I go leave on bare rock where fishermen fit dey dry their net. Dem no go rebuild the city again. I, the Almighty God don speak."
15 The Almighty God wan tell city of Tyre this: "When dem conquer una, people wey dey live along the coast go fear with the noise of those wey dem kill.
16 All the king of seafaring nation go come down from their throne. Them go remove their robe and their embroidered clothe and sit dey shake for ground. Dem go fear with una destiny that dey no go stop to dey shake.
17 Dem go sing this funeral song for una: The famous city don destroy! Dey don swept her ship commot for sea! people of this city rule the sea and dem trouble all those wey dey live for coast.
18 Now on the day wey you fall, the island go shake with fear, and their people dey shock for the destruction."
19 The Almighty God talk say: I go make una empty and destroy city where no one dey live. I go use water of the ocean depth cover una.
20 I go send una go world of dead to join people wey don live in ancient time. I go make una stay for underground world among eternal destruction, dey play with dead. As a result una no go be inhabitant and take una place again in the land of the living.
21 Other people go fear about wetin happen to una, e go finish for una. people go look at una, but dem no go see una again." Na wetin Almighty God talk be that.