Nigerian Pidgin Bible
Ezekiel 25
1 God speak to me.
2 He talk say, "Son of man", "speak against country of Ammon.
3 Tell dem make dem listen to wetin I, the Almighty God dey say: na una joy to see destruction of the Temple, to see say land of Israel don empty, to see people of Judah dey go foreign land.
4 But una happy, I go allow tribe from eastern desert conquer una. them do set up their camp for una country and settle for there. Them go eat the fruit and drink the milk wey suppose be una own.
5 I go turn city of Rabbah to place where camel go dey stay, and I go turn the whole country of Ammon to place where sheep dey sleep, so that una go know say I be God.
6 "This na wetin Almighty God dey say: una clap una hand and una jump for joy, una hate the land of Israel.
7 Because una do am, I go carry una give other nations wey go rob and destroy una. I go destroy una completely that una no go be nation again or get country of una own. Then una go know say I be God."
8 The Almighty God talk say, "Because Moab don talk say Judah be like all other nations.
9 I go let dem attack the cities wey defend border of Moab, including the finest cities- Beth Jeshimoth, Baal Meon, and Kiriathaim.
10 I go allow tribe of eastern desert conquer Moab, together with Ammon, so that Moab no go be nation again.
11 I go punish Moab, and dem go know say I be God."
12 God talk say, "The people of Edom take revenge on top Judah , and that revenge don bring lasting sin on top Edom.
13 Now I announce say I go punish Edom and I go kill every person and animal wey dey there. I go waste am from of Teman go city of Dedan and the people go die for battle.
14 My people Israel go take revenge on top Edom for me, and dem go make Edom feel my anger. Edom go know wetin e mean to be object of my revenge." The Almighty God don speak.
15 The Almighty God talk say, "The philistines don take wicked revenge on top their age-long enemies and don destroy dem fast.
16 And so I dey announce say I go attack the philistines and go destroy them. I go destroy everyone wey remain and dey live for philistine plain.
17 I go punish them severely and I go take full revenge on top them. Them go feel my anger. And then dem go know say I be God."