Nigerian Pidgin Bible
Exodus 36
1 "Bezalel, Oholiab, and other workers wey God don give skill and understanding, who know how dem go make everything dem go need to build the holy Tent, go make everything as God don command."
2 Moses call Bezalel, Oholiab, and all other skilled men wey God don give ability and who wan help, and Moses say make dem begin dey work.
3 Dem come collect all the offerings wey Israelites don bring for building the holy Tent. But people of Israel continue to dey bring their offering every morning.
4 The skilled men wey dey do the work go
5 and report to Moses say, "The people dey bring more than enough for the work wey God command say make we do."
6 Moses come send command all through the camp say make people stop to dey bring offering for holy Tent; naso people no dey bring again.
7 Wetin dem don bring don pass all dem need to finish the work.
8 Na the men wey get skill pass for the men wey dey work build the Tabernacle. Dem make am with ten pieces of fine linen wey dem weave with blue, purple, and red wool and decorate am with figure of creature wey get two wings.
9 Each piece na same size, twelve meters long and two meters wide.
10 Dem sow five of them together for one set and dem do the same with the other five.
11 Dem make loops of blue cloth for edge of the outside piece for each set.
12 Dem put fifty loops for first piece of first set and fifty loops wey match them on last piece of second set.
13 Dem make fifty gold hooks, wey dem use join the two sets to form one piece.
14 Then, Dem com make cover for the Tent out of eleven pieces of cloth wey dem make with goat hair.
15 Dem make am same size, thirteen meters long and two meters wide.
16 Dem join five of them together in one set and other six for another set.
17 Dem put fifty loops for edge of last piece of one set and fifty loops for edge of the other set.
18 Dem make fifty bronze hooks to join the two sets, so that e go form one cover.
19 Dem make two more coverings, one with ram skin wey don turn red and the other with fine leather, make e serve as outer cover.
20 Dem make upright frames with acacia wood for the Tent.
21 Each frame na four meters tall and 66 centimeters wide,
22 with two projections wey match, so that the frames fit join together. Na all the frames get the projection.
23 Dem make twenty frames for south side
24 and forty silver bases make dem go under them, two bases under each frame to hold two projections.
25 Dem make twenty frames for north side of the Tent
26 and forty silver bases, two under each frame.
27 For back of Tent, on the west, dem make six frames
28 and two frames for the corners.
29 Dem join the corner frame for bottom and connect am all way to top. Na the two frames wey form the corners dem make this way.
30 So na eight frames and sixteen bases, two under each frame.
31 Dem make fifteen crossbar with acacia wood, five for frames for one side of the Tent,
32 five for frames on other side, and five for frames wey dey west end, at the back.
33 The middle crossbar, dem extend am from one end of the Tent to other.
34 Dem cover the frames with gold and fit them with gold rings wey go hold the crossbar, wey them also cover with gold.
35 Dem make a curtain with fine linen, and weave am with blue, purple, and red wool and dem decorate am with figures of creature wey get two wings.
36 Dem make four post of acacia wood wey hold the curtain, cover them with gold hooks. Dem come make four silver bases wey go hold the posts.
37 Dem make curtain with fine linen wey dem weave with blue, purple, and red wool for Tent entrance, and dem decorate am with jewels.
38 For the curtain, dem make five posts fit with hooks, cover their tops and rods with gold, and make five bronze bases for the posts.