Nigerian Pidgin Bible
Exodus 25
1 God tell Moses say,
2 "Tell Israelites make dem make offering to me. Collect any offering dem wan give.
3 The offerings go be: gold, silver, and bronze;
4 fine linen; blue, purple, and red wool; cloth wey dem make with goat skin;
5 ram skin wey dem don dye red; fine leather; acacia wood;
6 oil for lamp; spices for anointing oil and for fragrant incense; carnelians and other jewels to set for ephod of High Priest and him breastpiece .
8 The people must make sacred tent for me, so that I fit live among them.
9 make una build am and furnish am according to the plan wey I go show una.
10 Make una build Box with acacia wood, 110-centimeter-long, 66-centimeter-wide, and 66-centimeter-high.
11 Cover am with gold inside out put gold border around am.
12 Make four gold rings to use dey carry am and attach am to the four legs, with two rings for each side.
13 Make poles wey una go dey use carry am with acacia wood and use gold cover am,
14 and put them inside the rings for each of the Box.
15 Make una no remove the poles from the rings.
16 Then put the two stone tablets I use write the commandment, wey I go give you inside the Box.
17 Make the Box cover with pure gold, 110-centimeter-long and 66-centimeter-wide.
18 Make two creatures wey get wing with hammered gold,
19 make one dey for each end of the Box. Make them so that dem go form one piece with the Box.
20 The creature wey get wings go face each other and dem go dey look down. Their wing go spread and cover am.
21 Put the two stone tablet inside the Box and put the cover on top am.
22 I go meet una for there, and I go give you all my laws for people of Israel between the golden creatures wey dey on top the Box cover.
23 Make una build a table with acacia wood, 88-centimeter-long, 44-centimeter-wide, and 66-centimeter-high.
24 Cover am with pure gold and put gold border round am.
25 Make a rim 75mm wide round am and gold border round the rim.
26 Make four rings with gold to dey carry am and put them for the four corner, where the legs dey.
27 The rings wey go hold the poles to dey carry the table, make e dey near the rim.
28 Make poles with acacia wood and cover am with gold.
29 Make plates, cups, jars, and bowls wey go dey for wine offering. Make all of them be pure gold.
30 Make una place the table for front of the Covenant Box, and make sacred bread always dey on top the table for offering to me.
31 Make a lampstand with pure gold. Make the base and shaft be hammered gold; the flower bud and petal wey decorate am, make dem form one piece with am.
32 Make six branch extend from the sides, three for each side.
33 Each of the six branches go get three decorative flower wey get shape like almond blossom with buds and petals.
34 Make the shaft of the lampstand get four decorative flowers wey get shape like almond blossom with buds and petals.
35 One bud go dey under each of the three pairs of branches.
36 Make the buds, the branches, and the lampstand be one single piece of hammered gold.
37 Make seven lamps for the lampstand and arrange them so that dem go shine go front.
38 Make the lamp tong and tray be pure gold.
39 Una go need 35 kilograms of pure gold to build the lampstand and the accessories.
40 Make una dey sure say una make everything according to the pattern wey I don show una on top mountain.