Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Exodus 18

1 Moses father-in-law Jethro, priest of Midian hear everything wey God don do for Moses and people of Israel when he lead them out of Egypt.

2 Naso he come meet Moses, and he bring Moses wife Zipporah, wey dem leave behind,

3 and her two sons, Gershom and Eleazar. (Moses don talk say, "I don be foreigner for strange land"; naso he don name one son Gershom.

4 He don also talk say, "God of my father don help me and save me, he no allow Egypt king kill me"; naso he name other son Eleazar.)

5 Jethro bring Moses wife and her two sons come desert where Moses dey camp for holy mountain.

6 He don send word to Moses say dem don dey come,

7 naso Moses go meet him, bow before him, and kiss him. Dem ask of each other health and dem go inside Moses tent.

8 Moses tell Jethro everything wey God don do to the king and people of Egypt in order to rescue Israelites. He tell am the hardship wey the people don go face on their way and how God don safe them.

9 When Jethro hear everything, he dey happy,

10 and say, "Praise the LORD, wey safe una from the king and people of Egypt! Praise the LORD, wey safe him people from slavery!

11 Now I know say God dey great pass all the gods, because he do am to those wey don treat him people arrogantly."

12 Jethro, Moses father-in-law come bring a burnt offering and other sacrifices to God, and Aaron come with Israel elders to eat meal with Moses father-in-law for presence of God.

13 The next day Moses sit down to serve as Judge for him people, and dem stand around him from morning till evening.

14 When him father-in-law see wetin Moses dey do for the people, he say, "Wetin you dey do for the people? Why only you dey sit as Judge, and these people dey stand around you from morning till evening?"

15 Moses answer him say, "Because people dey come to me to seek will of God.

16 When dem get dispute, dem dey come to me, and I go decide which of them dey right and I go tell them God commands and laws."

17 Jethro come say, "You no dey do am the right way.

18 You go wear out yourself and the people too. E too much for only you to dey do.

19 Make I give you good advice, and God go be with you. E dey right for you to represent the people before God and bring their dispute to him.

20 You go teach them God command and dey explain to them how dem go live and wetin dem suppose do.

21 In addition, you go choose some capable men and appoint them as leaders of the people: leaders of thousands, hundreds, fifties, and tens. Dem need to be God-fearing men wey get trust and wey no fit collect bribe.

22 Allow them serve as judges for people on permanent basis. Dem fit bring all the difficult cases to you, but dem fit decide small disputes. E go make am dey easier for you, as dem dey share your burden.

23 if you do am like this, as God commands, you no go wear yourself out, and all the people fit go home with their disputes settled."

24 Moses take Jethro advice

25 and choose capable men among Israelites. He come appoint them as leaders of thousands, hundreds, fifties, and tens.

26 Dem serve as judges for the people on permanent basis, and dem dey bring difficult cases to Moses, but dem dey decide smaller cases themselves.

27 Moses come say goodbye to Jethro, and Jethro go back home.

Open Bible reader