Nigerian Pidgin Bible
Exodus 16
1 All Israelites community come begin dey go from Elim, and on fifteenth day of second month after dem don leave Egypt, dem reach desert of Sin, wey dey between Elim and Sinai.
2 For the desert dem begin dey complain to Moses and Aaron say,
3 "We wish say God don kill us for Egypt. For there we fit sit down and eat meat, and eat as much food we wan eat. But you don bring us come this desert for hunger to kill us."
4 God come tell Moses say, "Now I go make food rain down from sky for all of una. The people must go out everyday to dey gather enough food for that day. For this way I fit test them to know if dem go follow my instruction.
5 For sixth day dem go gather food, and when dem prepare am, double of usual go dey.
6 Naso Moses and Aaron tell all Israelites say, "This evening una go know say na God bring una commot for Egypt.
7 For morning, una go see glory of God, because he don hear as una dey complain against him, and not against us, because we just dey carry out him instruction."
8 Then Moses com say, "Na God go give una meat for evening, and enough bread as una want for morning, because he don hear how much una dey complain against him. As una dey complain against us, na God u dey really complain against.
9 Moses tell Aaron say, "Tell the community make dem come stand before God, because he don hear their complain."
10 As Aaron dey follow them talk, dem turn go desert, and suddenly glory of God appear for cloud.
11 God tell Moses say,
12 "I don hear complain of Israelites. Tell them say dem go get meat to eat for evening, and for morning dem go get all the bread dem want. Dem go come know say I, the LORD, I be their God."
13 For evening, large number of quail come fly in and e cover the camp. And for morning, the camp area come dey wet with dew.
14 When the dew don dry, something wey be like ice come cover the ground.
15 When Israelites see am, dem no know wetin the thing be and dem begin dey ask each other say, "Wetin be this?" Moses come tell them say, "Na the food wey God don give una to eat be this.
16 God don command say make each of una dey gather as dem need am, two liters for every member of each family.
17 Israelites come do am, some even pack more, others pack less.
18 When dem measure am, the ones wey pack plenty no get too much, and the ones wey pack less no get too little. Each don pack wetin dem need.
19 Moses tell them say, "Make una no keep am for tomorrow."
20 But some of them no answer Moses and keep part of am. The next morning, e don get worms and e dey smell, and Moses come vex.
21 Every morning, each of them dey pack as dem need; and when sun don hot, the remaining one for ground dey melt.
22 On sixth day dem pack double portion of food, four liters for each person. Elders of community come tell Moses about am,
23 and he tell them say, "God don command say tomorrow na holy day of rest, make we dedicate am to him. Make una bake anything wey una wan bake today and boil wetin una wan boil. Anything wey remain, make una keep am for tomorrow."
24 As Moses don command, dem keep wetin remain till next day; e no spoil or get worms.
25 Moses come say, "Make una eat this today, because na Sabbath day, day of rest wey belong to God, and una no go find any food outside camp.
26 Make una dey gather food for six days, but on seventh day, resting day, e no go dey."
27 On seventh day, some of them go out say make dem go pack food, but dem no find.
28 God come tell Moses say, "How much long una go refuse to dey obey my command?
29 Remember say, I, the LORD, don give una a day of rest, and na why on sixth day I go always give una enough food wey go last for two days. Everyone go stay for where dem dey on seventh day and no go leave him home."
30 Naso the people no dey work on seventh day.
31 People of Israel dey call food manna. E be like small white seed, and e dey taste like biscuit wey dem make with honey.
32 Moses say, "God don command us say make we keep some manna for our descendants, so that dem go see the food wey he give us to eat for desert, when he bring us out of Egypt.
33 Moses come tell Aaron say, "Take a jar, put two liters of manna inside am, and put am for God presence make e be for our descendants."
34 As God don command Moses, Aaron put am for front of Covenant Box, so that dem go keep am.
35 Israelites come eat manna for forty years, until dem reach Canaan land, where dem settle.
36 The standard measure wey dem use then dey equal to twenty liters.