Nigerian Pidgin Bible
Exodus 12
1 God come follow Moses and Aaron talk for Egypt:
2 "Na this month go be first month of year for una.
3 Make you give Israel community these instructions: On tenth day of this month, each man go choose a lamb or a young goat for him family.
4 If him family dey too small, he go share one animal with him neighbor, according to number of people and amount wey dem fit eat.
5 You fit choose sheep or goat, but make e no old pass one year, and make e dey clean.
6 Then, the whole community go kill the animals, for evening of fourteenth day of the month.
7 The people go take the animal blood and put am for there doorposts and above door of house wey dem go eat the meat.
8 That night make dem roast the meat, and eat am with bitter herbs and with bread wey dem no use yeast make.
9 No eat am raw or boiled, but make dem roast everything, with the head, legs, and internal organ.
10 Make una no leave any till morning, if any remain, burn am.
11 Una go eat quick, because una go dress for travel, with una sandals for feet and stick for hand. Na Passover festival to honor me, God.
12 "For that night, I go pass through land of Egypt, and kill every firstborn male, human and animal, and punish all gods wey dey Egypt. I be God.
13 The blood for una doorstep go be sign to mark the houses wey una dey live. When I see the blood, I go pass over you and no go harm una when I dey punish Egyptians.
14 Una go dey celebrate this day as religious festival to dey remind una of wetin I, the LORD, don do. Celebrate am for all time to come.
15 God say, "For seven days, make nobody eat bread wey get yeast inside " make una eat unleavened bread only. On first day, you go get rid of the yeast wey dey your house, because if anyone eat bread wey get yeast during the seven days, he no go longer be one of my people.
16 On the first day and seventh day, una go meet for worship. Make una no work for those days, but una fit prepare food.
17 Keep the festival, because na the day wey I bring una tribes out of Egypt. You must celebrate am for time to come.
18 From evening of fourteenth day of the month to the evening of 21st day, una no go eat bread wey get yeast inside.
19-
20 For seven days, yeast no go dey una house, because if anyone, native-born or foreign eat bread wey get yeast, he no go be one of my people.
21 Moses come call leaders of Israel together and tell them say, "Each of una go choose a lamb or a young goat and kill am, so that una family go celebrate Passover."
22 Make una drain the blood inside bowl. Take a bundle of hyssop branch and soak am inside the blood, and use am wipe una doorpost and door beam above una house door. None of una go leave house until morning.
23 When God begin dey pass through Egypt to kill Egyptians, he go see the blood wey dey una beams and doorposts, and He no go allow Angel of Death enter una house and kill una.
24 You and your children must obey these rules for life.
25 When una enter the land wey God don promise to give una, una must perform this ritual.
26 When una children ask say, "Wetin this ritual mean?"
27 you go answer say, "Na Passover sacrifice to honor God, because he don pass over houses of Israelites wey dey Egypt. He kill Egyptians, but he spare us."" The Israelites come kneel down, and dem worship.
28 Dem come go do wetin God don command Moses and Aaron.
29 For midnight God come kill all firstborn sons for Egypt, from king son, who be heir to the throne, take reach son of prisoner wey dey for dungeon; He kill firstborn of all animals.
30 For that night, the king, him officials, and all other Egyptians wake up. People begin dey cry loud all through Egypt, because no house wey dead son no dey.
31 For that same night, the king come send for Moses and Aaron and he tell them say, "Make una dey go, you and your Israelites!
32 Commot for my country; go worship God, as una don ask. Make una take una sheep, goats, and cattle, and leave. Make you also pray for blessing for me."
33 The Egyptians come begin dey hurry them to leave the country; dem say, "All of us go die if una no leave."
34 Naso the Israelites take their bread before dem add yeast, dem wrap them inside cloth, and carry them for their shoulder.
35 The Israelites don do as Moses talk, and dem don ask the Egyptians for gold and silver jewelry and cloth.
36 God come make Egyptians respect Israelites and dem give them wetin dem ask for. Naso Israelites carry Egyptians wealth away.
37 The Israelites come begin dey waka dey go from Rameses go Sukkoth. Dem be like 600,000 men, and dem no count women and children.
38 Large number of other people and plenty sheep, goats, and cattle also follow them go.
39 Dem come bake bread with dough wey no get yeast wey dem bring commot for Egypt, because dem drive them commot for Egypt, so dem no get enough time to prepare food or prepare leaven dough.
40 The Israelites don dey live in Egypt for 430 years.
41 On the day wey the
430 years end, all tribe of God people come leave Egypt.
42 Na the night wey God keep watch to bring them commot for Egypt; dem come dedicate the same night to God for all time as night wey all Israelites must keep watch.
43 God come tell Moses and Aaron say, "Na Passover rules be these: no foreigner go eat Passover food,
44 but any slave wey una don buy fit eat am if una circumcise am first. No visitor or worker wey una hire fit eat am.
46 Na inside house wey dem prepare food dem must eat the food; make dem no take am outside. And make dem no break any of the animal bones.
47 Na all of Israel community must celebrate the festival,
48 but make any man wey dem no circumcise eat am. If foreigner don settle with una and wan follow una celebrate Passover to honor God, una must first circumcise all male wey dey him house. Una go come treat him like say him na Israelite, and he fit join the festival.
49 Na the same rule apply to person wey dem born as Israelites and foreigners wey settle among una."
50 All Israelites come obey and dem do wetin God don command Moses and Aaron.
51 For that day God bring Israelites out of Egypt.