Nigerian Pidgin Bible
Esther 6
1 The king no fit sleep for that same night, naso he order say make dem bring the official records of the empire and make dem read them to him.
2 The part wey dem read include the account of how Mordecai don expose a plan to kill the king - the plan wey Bigthana and Teresh make, the two palace servants wey dey guard the king room.
3 The king ask say, "How we don honor and reward Mordechai for this?" Him servants answer say, "We never do anything for him."
4 The king ask say, "Shey any of my official dey for the palace?." Now Haman just dey enter the courtyard; he don come to ask the king say make dem hang Mordechai on top the post wey dem dey use hang wey he don make ready.
5 Naso the servants answer say, "Haman dey here, he dey wait to see you." The king talk say, "Make una bring him in."
6 Naso Haman come in, and the king tell him say, "E get somebody wey I wish to honor. Wetin make I do for this man?" Haman think to himself say, "Who the king fit wan honor so much? Na me, of course."
7 So he con answer the king say, "Order make dem bring royal robes for this man - robes wey you dey wear by yourself.
8 Order say make dem put royal ornament on top your own horse.
9 Then get one of your noblemen to dress the man with these robes and lead him, as he dey climb on top the horse, through the city square. Make the noblemen announce as dem dey go say: "See how the king dey reward a person wey he wish to honor!""
10 Then the king tell Haman say, "Hurry and get the robes and the horse, and prepare this honors for Mordechai the Jew. Do everything wey you don suggest for him. You go see him dey seat for the entrance of the palace."
11 Naso Haman get the robes and the horse, and he con put the robes on Mordechai. Mordechai climb the horse, and Haman lead him through the city square, dey announce to the people as dem dey go say: "Make una see how the king don reward a man wey he wish to honor!"
12 Mordechai con go back to the palace entrance and Haman hurry dey go home, dey cover him face for shame.
13 He tell him wife and all him friends everything wey don happen to him. Then him wife and those him wise friends con tell him say, "You don start to dey lose power to Mordechai. Na Jew he be, and you no fit overcome him. He go defeat you for sure."
14 As dem still dey talk, the palace servant arrive in a hurry to take Haman go Esther party.