Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Esther 3

1 After some time, King Xerxes con promote the man wey dem dey call Haman to the position of prime minister. Haman na son of Hammedatha, wey be descendant of Agag.

2 The king order all the official for him service say make them show their respect for Haman make dem knee and bow to him. All of them do as king don talk, except for Mordecai wey refuse to do am.

3 The other officials for royal service ask him say why he dey disobey the command of the king;

4 Dem beg him day after day make he do am, but he no go gree. He explain say, "Na Jew I be," "and I no fit bow to Haman." Naso dem tell Haman about this, dem dey wonder if he go accept Mordechai behavior.

5 Haman con vex when he hear say Mordechai no go knee down or bow to him,

6 And when he con hear say Mordechai na Jew, he con decide to do pass make punish Mordechai alone. He plan to kill everyone wey dey for the whole Empire of Persian.

7 In the twelfth year wey King Xerxes don dey rule, for the first month, wey be the month of Nisan, Haman order say make dem cast the lots (dem dey call them "purim") to find out the right day and month to carry him plan out. Na the thirteenth day of the twelfth month, wey be the month of Adar dem decide.

8 So Haman tell the king say, "Certain race of people dey wey scatter all over your empire and dem dey for every province. Dem observe custom wey no be like those of any other people. Dem no dey obey the laws of the empire, so e go make sense if you no allow them.

9 If e con please Your Majesty, make you command say make dem kill them. If you do, I dey guarantee say I go fit put pass 340 tons of silver for royal treasury for the administration of the empire."

10 The king commot him ring, wey he dey use stamp announcements and con make them official, and give am to the enemy of the Jewish people, Haman son of Hammedatha, wey be the descendant of Agag.

11 The king tell him say, "The people and their money na your own; make you do as you like with them."

12 Naso on the thirteenth day of the first month Haman call the king secretaries and he dictate announcement wey dem go translate into every language and the system wey dem dey use write in the empire and make dem send am to all the rulers, governors, and officials. Dem issue am in the name of King Xerxes and stamp am with him ring.

13 Runners con take this announcement go every province of the empire. E contain the instructions say on a single day, the thirteenth day of Adar, all Jews - young and old, women and children - make dem kill them. Make dem slaughter them without mercy and take their properties.

14 Make dem make the announcement public for every province, so that everyone go dey prepare when that day don come.

15 At the king command dem make the decree public for the capital city of Susa, and runners carry the news go all the province. The king and Haman siddon and dem dey drink as dem put the city of Susa in confusion.

Open Bible reader