Nigerian Pidgin Bible
Ephesians 4
1 Mi wey bi prizina, bikos I dey serv di Oga; I dey beg una mak una dey liv una life as God wont.
2 Mak una dey get piti for won anoda wit quietnes, gentolnes and patient, bikos of di luv wey una get.
3 Mak una dey du evritin wey una fit du to kip di uniti wey di Spirit dey giv, as una dey liv togeda for peace.
4 Na won bodi and Spirit dey, bikos jos as all of una get won hope from God wen E kol una,
5 na so tu una get won Oga, won fate, won baptism,
6 won God and Papa wey dey above evribodi; dey yuz evribodi and dey insaid evribodi.
7 Bot God don giv grace to all of us akordin to haw Kraist gift plenti rish.
8 Na dis mak dem sey, "Wen e raiz-up go hevun, E kari meni prizinas wey E fri folo bodi and E giv plenti gift to pipol."
9 Na wetin dis wod, "E raiz-up," min? E min sey Kraist first die and dem bere am for di eart.
10 En wey dem bere, naim stil bi di pesin wey raiz-up pas di hevuns, so dat e go komplit evritin.
11 Na Kraist mak som of us apostols, profets, evangelist, pastors and tishas.
12 Kraist du laik dis to priper us for di ministri wok, wey go mak God shosh grow,
13 so dat wi go bi won for di tins wey wi biliv and wey go mak us rili no God Pikin. Den, wi go dey tink laik Kraist.
14 So mak wi nor bi laik shildren wey briz dey kari up and dan; shildren wey dey folo yeye tins wey humanbin dey tish and na dis tins dem dey tak disiv pipol.
15 Bot, as wi dey du wetin dey gud and koret wit luv, wi go dey grow for evri side kon mit Kraist wey bi di head.
16 Na from Kraist di hol bodi dey grow wel and join togeda tru di pawa wey dey sopot am. As ish part dey du en wok, na so di bodi go dey grow insaid God luv.
17 So, I dey yuz Kraist pawa tak tel una dis tins sey, mak una nor liv una life laik Gentai pipol wey dey tink onli bad and tins wey nor get sense.
18 Dia maind dey for daknes and dem nor get part for di life wey God dey giv, bikos dem stuborn and nor fit undastand.
19 Dem dey du wayo, dey giv dia bodi to yeye tins; tins wey nor dey pure and dey wiked.
20 Bot wi nor tish una laik dat abaut Kraist.
21 If na tru, den una don hear and learn di trut abaut am, jos as di trut dey insaid Kraist.
22 Konsanin di kaind life wey una dey liv bifor, wi sey mak una trowey dat bad spirit wey dey mak una du bad-bad tins
23 and mak una dey tink beta tins for una maind.
24 Den, tru raitiousnes and holines wey di trut dey bring, mak una wear di new man wey God don kreate laik ensef.
25 Since una don stop to lai, mak una start to tok trut giv una nebor, bikos all of us na membas for Kraist bodi.
26 If una dey ves, mak una nor sin and mak day nor dak stil mit una dey ves.
27 Mak una nor giv di devol eni shanse.
28 Pesin wey dey tif, mak e nor tif again. Insted, mak e wok hard and du gud wit en own hand, so dat e go fit giv pipol wey nor get.
29 Mak una nor alow eni bad wod kom out from una mout, bot mak una wod dey giv poor pipol hope, so dat e go bless pipol wey hear am.
30 Mak una nor du wetin go mak di Holi Spirit ves. Bikos na di Holi Spirit bi di mark wey God put for una bodi, so dat for jojment day, E go no doz wey E go save.
31 Una must stop to get bad bele, to dey ves, kworel and to dey tok bad-bad wod.
32 Mak una dey gud to won anoda; dey sori for pipol and dey forgiv ish oda, jos as God forgiv una tru Kraist.