Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Deuteronomy 20

1 When una go out to fight against una enemies and una see chariots and horses and army wey plenty pass una, make una no fear them. The LORD una God, wey safe una from Egypt, go dey with una.

2 Before una start to dey fight, make a priest come front and tell the army say,

3 "Soldiers of Israel, make una hear me! Today when una go battle, make una no fear the enemy, and when una see them, make una no panic.

4 The LORD una God go fight for una side and help una win the battle."

5 Then the officers go address the troops: if any of una don build a new house, but never move in, una fit go home. E no dey right for una to die for battle and for another person to live for una new house.

6 If any of una don plant a vineyard but never get first grape harvest, una fit go home. E no dey right for una to die for battle make another person go enjoy una grapes.

7 If any of una don engage to marry, una fit go back and marry. E no dey right for una to die for battle make another person go marry the woman wey una don engage.

8 Finally, if any of una dey fear, una fit go home. We no wan make una discourage other soldiers.

9 When the officials don finish to dey give these orders, dem go appoint officers wey go dey in command of the army.

10-

15 Before una attack a town wey dey far from una land, make una offer peace to the people wey dey live for there. If dem surrender and open their town gates, dem go become una slaves. But if dem reject una offer of peace and try fight una, make una surround their town and attack them. Then, after God don help una capture am, make una kill all the men. Take all the women and children as slaves and keep the animals and everything else wey get value.

16 Anytime una capture town for the land the LORD una God dey give una, make una dey sure say una kill all the people and animals.

17 He don command una to wipe out the Hittites, the Amorites, the Canaanites, Perizzites, Hivites, and Jebusites.

18 If una allow them live, dem go trick una to worship their gods, and una go dey unfaithful to the LORD.

19 When una dey attack a town, make una no destroy the fruits, even if una don surround the town for long time. Fruit, trees no be una enemies, and dem dey produce food wey una fit eat, so make una no cut them down.

20 Una fit need wood to make ladders and towers to help una get over the walls and capture the town. But make una only use trees wey una know say e no be fruit trees.

Open Bible reader