Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Daniel 10

1 (for the third year wey Cyrus be emperor of Persia, Daniel wey dem dey call Belteshazzar see one message. Na true message but e dey hard to understand. But he get the meaning for dream.)

2 At that time I dey cry for three weeks.

3 I no eat any rich food or any meat, drink any wine or comb my hair until three weeks pass.

4 I dey stand for the side of mighty River Tigis on day

24 of the first month of the year.

5 I look up and I see person wey wear linen cloth and belt of fine gold.

6 Him body dey shine like jewel. Him face bright like flash of lightning, and him eyes dey burn like fire. Him arm and leg dey shine like bronze wey dem polish, him voice dey sound like the shout of many people.

7 Na only me see the vision, people wey dey near me no see anything, but dem fear, run go hide for somewhere.

8 Dem leave only me for there dey see the amazing vision. I no get strength again and my face don change so tey nobody sabi me again.

9 I no know when I fall for ground and face down when I hear him voice.

10 I still dey shake when one hand hold me, raise me to my hand and knee.

11 The angel tell me say, "Daniel, God love you, so stand up and hear wetin I wan talk carefully. He don send me to you." As he dey talk this, I stand up as I still dey shake.

12 Na so he talk say, "Daniel, no dey fear. God don hear your prayer since the first day wey you don decide to humble yourself to gain understanding. I don come as answer to your prayers.

13 The angel prince of kingdom of Persia don dey against me for 21days. And then Michael wey be one of the chief angel con help me, because na only me dey Persia.

14 I don come to make you understand wetin go happen to your people for future. This na vision about future."

15 As he talk this, I dey look ground and I no know wetin I go talk.

16 And the angel wey be like human being, use hin hand touch my lip. I tell am say, "Sir, this vison weak me and I no fit stop to dey shake.

17 I be like slave wey stand for him master front. How I fit talk to you? Breath or strength don comot for my body."

18 And I feel stronger as he hold me again.

19 He tell me say, "God love you, so no allow anything worry you or fear you." As he talk this, I con dey feel even stronger and I tell am say, "Sir, tell me wetin you wan talk. You don make me feel better."

20-

21 He ask me, "You know why I con meet you? Na to tell you wetin dey the book of truth. Now I go come go back go fight the guardian angel of Persia, after that the guardian angel of Greece go appear, nobody wey fit help me except angel Michael wey be guardian angel for Israel.

Open Bible reader