Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Amos 1

1 Na the word of Amos, one shepherd wey come from the town of Tekoa be this. Two years before earthquake wey happen, wen Uzziah be king of Judah and Jeroboam son of Jehoash be king of Israel, God show Amos all these things about Israel.

2 Amos talk say, God shout from mount Zion; him voice loud from Jerusalem. The field dry up and grass for mount Carmel turn brown."

3 God say, people for Damascus don sin again and again and na why I go punish dem. Dem crush people of Gilead with iron threshing tools.

4 Na so I go send fire on top palace wey king Hazal build and I go burn the strong wall wey king Benhadad get.

5 I go destroy gate of Damascus city and I go remove the people wey dey live for the valley of Aven and rulers of Betheden. Dem go carry people for Syria go as prisoners for the land of Kir."

6 God talk say, "People of Gaza don sin again and again, and na why I go certainly punish dem. Dem carry one whole nation sell give people of Edom as slaves.

7 So I go send fire on top the city walls of Gaza wey go destroy high towers for Gaza.

8 I go remove the rulers wey dey the city of Ashdod and Ashkelon. I go punish the city of Ekron, and all the Philistines wey remain go die."

9 God talk say; the people of Tyre don sin again and again, and na why I go punish dem. Dem carry one whole nation send go be slave for Edom, dem no remember agreement wey dem don make with their brothers.

10 So I go start fire for walls of Tyre wey go destroy the high tower of Tyre."

11 God talk say; people of Edom don sin again and again, and na why I go certainly punish dem. Dem kill their relatives, the Israelites, and dem no show dem mercy. Their vex no get end, and dem no allow am go down.

12 So I go send fire on top the city of Teman and I go burn the high tower of Bozrah."

13 God talk say, "the people of Ammon don sin again and again and because of this I go certainly punish dem. As dem dey fight for more territory, dem kill pregnant woman for Gilead.

14 To I go send fire upon the city walls of Rabbah and I go burn their high towers. Trouble go come to dem like storm for their country.

15 God talk say, na their kings and their leaders dem go capture. Dem go take all of dem together."

Open Bible reader