Nigerian Pidgin Bible
Acts 14
1 For Ikonium, Pol and Banabas go insaid di Ju sinagog and dem prish sotey meni Ju and Greek pipol kon biliv God wod.
2 Bot di Ju pipol wey nor gri biliv, gada di Gentai pipol kon spoil dia maind against Pol and Banabas.
3 Di apostols stay der tey wel-wel and dem tok wit boldnes abaut God, wey show sey dia mesage abaut en gudnes na tru, bikos E kon giv dem pawa to du meni mirakols and wondas.
4 Bot di pipol wey dey di tawn kon divide; som dey di Ju side and som dey di apostol side.
5 Wen di Gentai and di Ju pipol (wit di oga dem wey dey rule dem) kon trai to sofa and stone di disaipols,
6 Pol and Banabas kon no abaut am, so dem kon run go Lystra and Derbe wey dey for Lycaonia and all di aria wey dey near der
7 and dem kontinu to dey prish for der.
8 For Lystra, dem mit won man wey nor fit waka since wen dem born am.
9 Di man dey listin to Pol as e dey tok. Wen Pol kon luk am for eye kon si sey e get fate wey go fit heal am,
10 e tel am, "Stand up." Di man kon jump up and e bigin waka.
11 Wen di pipol si wetin Pol du, dem kon shaut for Lycaonian language sey, "Awa gods don turn to humanbin kom mit us."
12 Dem start to kol Banabas, "Zeus" and Pol, "Hermes", bikos na Pol dey lid dem.
13 Di prist wey dey woship di god wey dem dey kol Zeus wey en shrine dey outsaid di tawn kon bring melu and flawas kom di tawn gate; so dat en and all di pipol go sakrifais giv di apostols.
14 Wen Banabas and Pol hear abaut di tin wey di pipol won du, dem shaut, tear dia klot kon run go mit di pipol sey,
15 "Why una won du dis kaind tin? Wi tu na humanbin laik una! Wi kon tel una di Gud News, wey go mak una turn from sin kom mit God, wey mak hevun, eart, sea and all di tins wey dey insaid dem.
16 "Bifor-bifor, E let difren tribes dey du as dem laik,
17 bot E nor stop to du gud for una, E dey giv una rain from hevun and fud from groun, so dat una go chop and bele go swit una."
18 Upon all dis tins wey Pol and Banabas tok, dem nor fit stop di pipol mak dem nor du di sakrifias.
19 Bot afta som Ju pipol wey kom from Antiok and Ikonium don win di pipol maind, dem kon stone Pol, drag am komot from di tawn, bikos dem tink sey e don die.
20 And as di disaipols gada roun am, e get up kon waka go bak to di tawn. Di next day, en and Banabas kon komot go Derbe.
21 Afta dem don prish God wod for dat tawn and meni pipol don turn from sin kom mit God, dem kon go bak to Lystra, Ikonium and Antiok.
22 Dem enkorage di disaipols sey mak dem get heart and mak dem kontinu to dey biliv sey, "Wi go must sofa wel-wel for pipol hand, bifor wi go fit enta God Kindom."
23 Wen dem don shuz eldas wey go lid di bilivas for di difren-difren shosh, dem kon pray and fast sey, mak God protet dem.
24 Dem kon liv Pisidia go Pamfilia
25 and wen dem don prish for Perga, dem kon go Attalia.
26 From der, dem enta ship go Antiok, wer dem for first pray for dem, for di wok wey dem jos finish naw.
27 Wen dem rish Antiok, dem gada di pipol kon tel dem all di tins wey God yuz dem du and haw E opun road for Gentai pipol to biliv.
28 So dem stay der for somtaim wit di bilivas.