Nigerian Pidgin Bible
Acts 1
1 My frend Teofilos, for di book wey I first rite giv yu, I tok abaut all di tins wey Jisos Kraist start to dey du and tish,
2 ontil di day wen God kon kari am go hevun, afta e giv orda to di apostols, wey e shuz wit di Holi Spirit.
3 Na di same apostols e show ensef meni taim sey, e stil dey alaif, afta di sofa wey e sofa. Dem si-am for forti days and e tel dem abaut God kindom.
4 Den wen e folo dem sidan dey tok, e kon komand dem sey, "Mak una nor liv Jerusalem, bot mak una wait for di tin wey my Papa promis wey I don tel una bifor.
5 "Jon dey baptaiz wit wota, bot e nor go tey wen God go baptaiz una wit en Holi Spirit (wey go kontrol una life foreva)".
6 So wen dem gada, dem kon start to ask Jisos Kraist, "Oga! Na naw yu go start to rule Izrel?"
7 Jisos ansa dem, "Di taim wey God plan nor konsan una,
8 bot una go get pawa wen di Holi Spirit don enta una life and una go tel pipol abaut mi for Jerusalem, for evriwer for Judea and Samaria go rish all di far place wey dey dis wold."
9 So afta e don tok wit dem, God kon kari am up ontil kloud kova am and dem nor fit si-am again.
10 As dem stil dey luk up as e dey go, tu men wey wear white klot stand near dem
11 kon sey, "Galili pipol, na wetin mak una stand der dey luk hevun laik dat? Dis Jisos Kraist wey God don kari go hevun today, go stil kom bak di same way wey una si-am dey go hevun."
12 So dem waka go bak to Jerusalem from Mount Olives (wey dey near Jerusalem and di place wey dem waka so, far pas haw di law dey alow pipol waka for Sabat Day).
13 Wen dem enta Jerusalem, dem kon go di room for upstair wer dem dey stay. Pita and Jon; James and Andru; Filip and Tomas; Batlomi and Matiu; James wey bi Afius pikin, Saimon wey dem dey kol Zilot and Judas wey bi James pikin, na all of dem gada for der.
14 Dem kon dey pray togeda evriday wit won maind, wit all di wimen, plus Mary, Jisos Kraist mama and en brodas.
15 Di pipol wey dey pray, plenti rish won ondred and twenti. So Pita stand-up for di pipol front kon sey,
16 "My brodas, di wod wey di Holi Spirit yuz David tok abaut Judas, wey show road to di pipol wey arres Jisos Kraist, must hapun,
17 bikos e dey awa grup bifor and e dey folo us du di wok."
18 (Dis Judas buy won land wit di moni wey e kolet for di wiked tin wey e du and na der e hang ensef til en bele burst and all en intestine kon skata kom out,
19 sotey all di pipol for Jerusalem hear di stori and naim mak dem dey kol di place for dia language, 'Akeldama, wey min, Blood Land). '
20 "For Psalm book, God wod sey, 'Mak en haus empti, mak nobodi stay der again and mak anoda pesin tak en place. '
21 "So, mak won pesin from di men wey dey folo us since di taim wey Oga Jisos Kraist dey wit us,
22 from wen dem baptaiz am, ontil e go up liv us, mak e kon join us tel pipol di trut sey, Jisos Kraist don raiz-up from grave."
23 So dem shuz tu men, won na Josef wey dem dey kol Basabas (bot oda pipol dey kol am Justus) and di oda won, na Matias.
24 Den dem kon pray, "Oga Jisos Kraist, na yu no wetin dey insaid evribodi maind. Mak yu show us di pesin wey yu wont among dis tu pipol,
25 so dat e go tak Apostol Judas, wey kil ensef, place."
26 Naim dem kon vote to shuz bitwin di tu men and di pesin wey dem shuz, na Matias.