Nigerian Pidgin Bible
Zephaniah 2
1 Shameless nation, make una come to una senses,
2 before e go dey too late for una. God don set time when him terrible anger go strike like storm and blow una commot.
3 If una obey God, then come worship him. If una dey do right and calm down, maybe una go dey safe for that day when God go loose him temper.
4 Nobody go remain for Gaza and Ashkelon. Ashdod go dey empty for day and other people go pursue people of Ekron from their city.
5 To una people of Philistia, wey dey live along the coast, na wetin God talk be this: I be una enemy now and I go destroy una!
6 Una seacoasts go turn open field wey shepherd go dey keep their sheep.
7 The people of Judah wey survive go occupy una land. Dem go put their animals for there and sleep for the house of Ashkelon. The LORD their God go dey with them and make them prosper again.
8 Almighty God talk say, I don hear the people of Moab and Ammon dey insult and provoke my people and dem dey brag say dem go take their land.
9 As long as I still be the living LORD, God of Israel, I swear say, Moab and Ammon go perish like Sodom and Gomorrah salt pit go cover am forever. Then my people wey survive go take their land.
10 Naso people of Moab and Ammon go be punished for their pride and arrogance and for insulting the people of God Almighty.
11 God go bring fear on them. He go reduce the gods for earth to nothing, and then every nation go worship him, each of them for their own land.
12 God go also kill the people of Ethiopia.
13 God go use him power destroy Assyria. He go make Nineveh empty and perish, a desert wey no get water.
14 E go be place where flocks, herds, and animals of all kind go lie down. Owls go live among hin ruins and go cry from the window. Crow go cry loud for the doorstep. The cedar wood of her building go lost.
15 Na that be wetin go happen to the city wey dey proud of their own power and dey think say e dey safe. The people think say na their city great pass for the whole world. E go become empty, a place wey wild animal go dey rest! People wey pass go whistle and dem go shake their head when dem see say the city don perish.