Nigerian Pidgin Bible
Psalms 69
1 Save me, O God; the water don reach my neck;
2 I dey sink inside deep mud, and solid ground no dey; I dey inside deep water, and wave wan cover me.
3 I don tire to dey call for help, and my throat dey pain me. I don strain my eye, as I dey look for help.
4 Those wey hate me for no reason plenty pass the hair wey dey my head. My enemy dey lie against me; dem strong and dem wan kill me. Dem make me give back wetin I no steal.
5 O God, I no hide my sin from you; you know how foolish I been dey .
6 No allow me bring shame on those wey trust you, Sovereign LORD Almighty! No let me bring disgrace to those wey dey worship you, O God of Israel!
7 Na because of you dem been insult me and na why shame cover me.
8 I be like stranger to my relatives, like foreigner to my family.
9 As I devote myself to your temple e dey burn inside me like fire; the insult wey dem dey throw at you dey fall on me.
10 I dey fast, to humble myself, and people dey insult me;
11 I dress myself for cloth wey dem dey use to dey mourn, and dem dey laugh me.
12 Dem dey talk about me for street, and drunk person dey make song about me.
13 But as for me, I go pray to you, LORD; God, answer me for anytime wey you want. Make you answer me because of your great love, because you dey keep your promise to save.
14 Save me make I no sink for mud; keep me safe from my enemy, save me from deep water.
15 No allow flood come over me; no let me sink inside water or sink inside grave.
16 God, answer me in the goodness of your love wey dey constant; make you turn to me in your compassion!
17 No hide yourself from your servant; I dey for trouble - make you answer me now!
18 Come meet me and make you save me; come save me from my enemy.
19 You know how dem dey insult me, how dem disgrace me and how dem dishonor me; you dey see all my enemy.
20 Insult don break my heart, and I dey hopeless. I been dey hope for sympathy, but none dey; I dey hope for comfort, but I no find any.
21 When I dey hungry, dem give me poison; when I dey thirsty, dem give me liquid wey sour.
22 Make their banquet cause destruction for them; make their feast cause their downfall.
23 Make you strike them blind! make their back always dey weak!
24 Make you vex with them well; allow your anger overtake them.
25 Make you empty their camp; make nobody dey alive for their tent.
26 Dem dey trouble those wey you don punish; dem dey talk about those wey you wound on how dem suffer.
27 Make you keep evidence of their sin; no let them be part of your salvation.
28 Make you clear their name commot from the book of the living; make dem no dey for the list of your people.
29 But I dey inside pain and trouble; O God, come lift me up and save me
30 I go praise God with song; I go proclaim him greatness with thanksgiving.
31 This go please the LORD pass make I dey offer am cattle, pass make I dey sacrifice complete bull.
32 When those wey dem oppress see this, dem go happy; those wey dey worship God go get confidence.
33 God dey hear those wey dey in need and him no dey forget him people for prison.
34 Praise God, O heaven and earth, seas and all creature wey dey inside them.
35 Him go save Jerusalem and him go build town of Judah again. Him people go live for there and dem go take over the land;
36 The descendant of him servant go inherit am, and those wey love am go live for there.