Nigerian Pidgin Bible
Psalms 65
1 God, e dey right for us to praise you for Zion and keep our promise to you,
2 because you dey answer prayers. People wey dey everywhere go come meet you for their sin.
3 Our fault dey defeat us, but you dey forgive them.
4 Those wey you choose go happy, those wey you bring to dey live for sanctuary. We go dey satisfied with the good things wey dey your house, the blessings wey dey for your holy Temple.
5 You dey answer us by giving us victory, and you dey do wonderful things to save us. People wey dey all over the world and across the sea dey trust you.
6 Na you put the mountains for where e suppose dey by your strength, e dey show your mighty power.
7 You dey make sea and the noise of the wave calm down; you dey calm down disturbance of the people.
8 The whole world dey stand dey wonder about wetin you don do wey dey great. Your action dey bring shout of joy from one end of earth to another.
9 You dey show say you care for the land by sending rain, you make am rich and fertile. You full the stream with water; and you provide crops for the earth. Na how you dey do am be this:
10 You been send plenty rain on top the field and you soak am with water, you shower the soil with rain to make am soft and you come make the young plant to dey grow.
11 Your goodness dey provide rich harvest! Anywhere you go plenty dey there.
12 The grassland dey full of sheep; the hillside dey full of joy.
13 Sheep don cover the field; the valley dey full of wheat. Everything dey shout and sing for joy.