Nigerian Pidgin Bible
Psalms 6
1 LORD, make you no vex condemn me, make you no punish me as you dey vex!
2 O LORD, I don worn out; make you pity me: Give me strength; I dey very weak completely
3 and my whole life no dey settle. O LORD, how long you go con wait to help me?
4 God, come save me; use your mercy make you free me from death.
5 Dem no dey remember you for world of the dead; nobody fit praise you for there.
6 Pain don make me tire; every night my cry dey wet my bed; cry dey soak my pillow.
7 I dey find am hard to see; my eyes don swell up from cry wey my enemy cause.
8 You evil people, make una no come near me; God dey hear as I dey cry;
9 he dey hear me cry for help and him go answer my prayer.
10 My enemy go know how shame of defeat dey bitter; dem go drive them commot with confusion.