Nigerian Pidgin Bible
Psalms 36
1 Sin dey speak deep inside the wicked heart; dem dey reject God and dem no dey appreciate him.
2 Because dem dey think high of themselves, dem think say God no go know about there sin and condemn am.
3 Na wicked talk dem dey talk and na lie full inside; dem no dey do wetin dey wise and good again.
4 As dem dey lie on top their bed dem dey make evil plan; nothing wey dem dey do dey good. And dem no dey reject any evil thing.
5 LORD, your constant love dey reach heaven; your faithfulness dey reach sky.
6 Your righteousness dey high like mountain; your justice be like depth of the sea. People and animal dey for your care.
7 O LORD, your constant love dey precious! We dey find protection under the shadow of your wings.
8 We dey chop from plenty food wey you provide; and you allow us drink from river of your goodness.
9 Na you be the source of all life, and na your light dey make us dey see light.
10 Continue dey love those wey know you and do good to those wey dey righteous.
11 No allow people wey dey proud attack me or wicked people make me run commot.
12 See where evil people don fall. Dem dey lie for there, dem no fit stand up.