Nigerian Pidgin Bible
Psalms 15
1 LORD, who fit enter your temple? Who fit worship on top Zion, your holy hill?
2 Those wey dey obey God for everything and wey dey do right, wey their word na truth and no be lie,
3 and wey know dey talk bad things about others. Dem no dey do wrong to their friends or dey carry rumor around.
4 Dem dislike those wey God reject, but make you honor who dey obey the LORD. Dem dey always do wetin dem promise, no matter how much e go cost.
5 Dem dey give loan without interest and dem no fit collect bribe to bear witness against innocent person. Anybody wey do all these things go always dey safe.