Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 138

1 LORD na with all my heart I dey praise you; I dey sing praise give you before the gods.

2 I bow down face your holy Temple, and praise your name because of your love wey no dey change and faithfulness, because you don show say your name and your command na highest authority.

3 You dey answer me when I call you for help; you give me power with your strength.

4 LORD, all the king wey dey dis world go praise you, because them don hear your promise.

5 Dem go sing about wetin you don do and about your great glory

6 Even though say you dey high above, you dey take care of the low people, and those wey proud no fit hide from you.

7 When trouble surround me, you dey keep me safe. You dey oppose my enemy wey dey vex and you save me by your power.

8 You go do everything wey you promise; LORD, your love dey last forever. Complete the work wey you don start.

Open Bible reader