Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 114

1 When people of Israel commot for Egypt, when Jacob descendant commot from that foreign land,

2 Judah con turn holy people of the LORD, Israel turn him own.

3 The Red Sea look and run commot; the Jordan River stop to dey flow.

4 The mountain dey skip like Goat; the hill dey jump around like lamb.

5 Sea, wetin happen wey make you run away? And you Jordan, why you stop to dey flow?

6 You mountain, why you dey skip like goat? You hill, why you dey jump around like lamb?

7 Earth, make you tremble for the coming of the LORD, for the presence God of Jacob,

8 Wey change rock to water and change hill to spring wey dey flow.

Open Bible reader