Nigerian Pidgin Bible
Psalms 10
1 Why you dey far away, O LORD? Why you dey hide yourself when we dey for trouble?
2 The wicked dey proud and dem dey oppress the poor; catch them for the trap wey dem make.
3 The wicked dey happy for the evil wey dem dey do; the greedy dey curse and dem reject the LORD.
4 The wicked no care about God; for their pride dem think say God no matter.
5 The wicked dey succeed for everything. Dem no fit understand God judgement; dem dey mock their enemy.
6 Dem dey tell themselves say, I no go ever fail; I no go ever dey for trouble
7 Their talk dey full of curses, lies and threats, dem dey quick to speak hate and evil words.
8 Dem dey hide themselves for villages, dey wait to kill innocent people. Dem dey watch helpless victim;
9 dem dey wait for hidden places like lions. Dem lie and wait for poor people; dem catch them for their trap and drag them away.
10 Dem dey hurt people wey don weak and dem dey suffer again and again .
11 The wicked tell themselves say, God no care; He don close him eye and him no go ever see me
12 O LORD, make you punish this wicked people! Remember those wey dey suffer.
13 How the wicked fit hate God and tell themselves say, He no go punish me?
14 But you dey see; you dey take notice of trouble and suffer and you dey ready to help always. The helpless dey commit themselves to you; you dey always help the poor.
15 Make you break the power of wicked and evil people; punish them for the bad thing wey dem don do until dem no do am again.
16 God na King for ever and ever. Those wey dey worship other gods go disappear from him land.
17 O LORD, you go listen to the prayer of the humble; and u go give them courage.
18 You go hear the cry of the oppressed and orphans; you go judge in their favor, so that ordinary men no go cause trouble again.