Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Psalms 1

1 Those wey dey reject advice from evil people go receive blessing, those wey no dey follow way of sinners or join those wey dey do bad-belle about God.

2 Instead, dem dey find joy when dem dey obey the law of God, and dem dey study am day and night.

3 Dem be like tree wey dey grow beside river, wey dey commot fruit wen time dey right and the leave no dey dry.

4 But evil people no be like dis at all: dem be like grass wey wind dey blow commot.

5 God go condemn sinners and him go keep them away, apart from God people

6 Na God dey guide and protect the righteous, but the evil people dey their road to death.

Open Bible reader