Nigerian Pidgin Bible
Proverbs 7
1 My pikin, remember wetin I talk, and make you no forget wetin I tell you say make you do.
2 Do wetin I talk, and you go live. Make you dey careful to dey follow my teaching like you suppose dey protect your eyes.
3 Make you keep my teaching with you all the time, and write am for your heart.
4 Treat wisdom as your sister, and treat understanding like your close friend.
5 Na dem go keep you away from other man wife, na dem go keep you from women with sweet words.
6 One day I dey look out of the window of my house,
7 And I see plenty young men wey no get experience, but I con notice one foolish person in particular.
8 He dey waka along the street near corner where one certain woman dey live. He dey waka pass her house
9 for evening after everywhere don dark.
10 And she con meet him; she dey dress like prostitute and she dey make plans.
11 She be bold woman wey no get shame wey dey always waka for street
12 or stand dey wait for corner, sometimes for street, sometimes for market place.
13 She con throw her hand round the young man, kiss him, look him eye to eye, and talk say,
14 I don make my offering today and I get the meat from sacrifices.
15 Naso I come out to dey look for you. I wan come find you, and you dey here!
16 I don cover my bed with sheets of colored linen from Egypt.
17 I don put perfume on top am with myrrh, aloes, and cinnamon.
18 Come on! Make we make love all night long. We go dey happy for each other hand.
19 My husband no dey house. He don go away on a long journey.
20 He carry plenty of money with him and he no go come back for two weeks.
21 Naso she con deceive him with her charms, and he fall for her sweet talk.
22 Suddenly he come dey go with her like bull wey dem wan go slaughter, like deer wey jump enter trap
23 Where arrow go break hin heart. He be like bird wey dey enter net - he no know say him life dey for danger.
24 Now, my pikin, make una listen to me. Make una pay attention to wetin I dey talk.
25 Make una no allow that kind woman win una heart; make una no go dey look for her.
26 Na she be the destruction of plenty men and she don cause the death of plenty wey we no fit count.
27 If una go her house, una don dey the road to the world of the dead. Na short cut to death e be.