Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Obadiah 1

1 Na prophesy of Obadiah be this - wetin the Almighty God say about nation of Edom. God don send him messenger go the nations, and we don hear him message: “Make una get ready! Make we go war against Edom!”

2 God tell Edom say, “I go make una weak; everybody go hate una.

3 Una pride don deceive una. Una capital na strong tower of solid rock; una home dey high for mountains, and so una tell unaself say, ‘Who fit pull us down?’

4 Even if una make una home high like eagle nest, wey e be like say e dey among stars, I go still pull una down.

5 “When thieves come for night, na only wetin dem want dem go take. When people gather grape, dem dey always leave small. But una enemy don wipe una commot completely.

6 Descendant of Esau, dem don steal una treasure.

7 Una friends don deceive una; dem don drive una commot from una country. People wey dey for peace with una don defeat una. Those friends wey una dey chop together don set trap for una; dem talk of una say, ‘Where all the wisdom wey he get?’

8 “On the day wey I punish Edom, I go destroy their wise men and I go wipe all their wisdom commot.

9 Fighting men of Teman go fear, and every soldier for Edom go die.

10 Because una rob and kill una brother, the descendant of Jacob, una go perish and disgraced forever.

11 Una stay for one side on that day when enemy con break down their gate. Una bad like those stranger wey carry Jerusalem wealth commot and divide am among themselves.

12 Una no suppose don rejoice in trouble of una brother for Judah. Una no suppose happy on the day of their destruction. Una no suppose laugh them in their trouble.

13 Una no suppose enter the city of my people to rejoice over their suffering and to seize the riches wey be their own on the day wey dem dey for trouble.

14 Una no suppose stand for cross road, to catch those wey wan escape. Una no suppose hand them over to their enemy on the day when dem dey for trouble.

15 “The day don near when I, the LORD, go judge all nations. Edom, dem go do to una wetin una don do others. Una go get back wetin una don give.

16 My people don drink bitter cup of punishment on top my holy hill. But all nation wey dey around go drink plenty bitter cup of punishment; dem go drink everything and dem no go exist again.

17 “But some go escape on top Mount Zion, and e go be holy place. People of Jacob go possess the land wey be their own by right.

18 The people of Jacob and Joseph go be like fire; dem go destroy people of Esau like fire dey burn straw. No descendant of Esau go survive. I, the LORD, don speak.

19 “People from southern Judah go occupy Edom; those from western foothill go capture Philistia; people of Israel go take territory of Ephraim and Samaria; the people of Benjamin go take Gilead.

20 The army of foreign land from northern Israel go return and defeat Phoenicia take reach Zarephath for north. The people of Jerusalem wey don go foreign land for Sardis go capture towns of southern Judah.

21 The victorious men of Jerusalem go attack Edom and rule am. And the LORD himself go be king.”

Open Bible reader