Nigerian Pidgin Bible
Numbers 32
1 32 Reuben and Gad tribe get plenty animals, when dem see say land of Jezeal and Gilead Dey good for cattle,
2 dem go meet Moses, Eleazar, and other community leaders and say,
3-4 God don help us capture the land wey dey around towns of Ataroth, Dibon, Jazer, Nimrah, Heshbon, Elealeh, Sebam, Nebo, and Beon. Na good land for animal, and since we get plenty cattle and sheep,
5 shey una go allow us stay here for east of Jordan River and make the land be our own?
6 Moses come reply say, Shey una wan stay here when una fellow-Israelites go war?
7 If una do am, other people no go wan cross Jordan River to the land wey God don promise them.
8 Na same thing wey happen when I send una ancestor from Kadesh Barnea say make dem go check the land.
9 Dem reach Eshcol Valley, dem come back and tell the people say make we no enter am.
10 God begin dey vex,
11-13 and promise say no man wey don reach 20 years or older when dem leave Egypt go enter the land wey he don promise Abraham, Isaac, and Jacob. Dem no dey loyal to me, apart from Caleb and Joshua dem dey faithful to me, but he dey vex with others and he make dem to just dey waka inside desert for 40 years. By that time, everyone wey sin against him don die.
14 Now, you people of Reuben and Gad don dey do same thing and una dey make God dey vex more.
15 If una reject God, he go leave him people again, and leave them for here inside desert. And na una we go blame!
16 Reuben and Gad men come answer say, Allow us make we build place to keep our sheep and goats, and towns for our wives and children,
17 where dem fit stay and dey safe. We go come prepare to fight and lead other tribes go battle.
18 We go stay with them till dem don settle for their own tribe land.
19 The land wey dey other side of Jordan River go be our own, so that we no go dey expect land for other side.
20 Moses say, If una really mean wetin una talk, then make una go get ready to fight for God.
21 Una gree to cross Jordan and stay with the rest of Israelites, till God force our enemies comot for the land. If una do these things,
22 then after God don help Israel take the land, una fit go back to una land. Una no go need to stay with others again.
23 But if una no keep una promise, una don sin against God, and una go receive punishment.
24 Make una start to dey build town for una wife and children, and place for una sheep and goat. But, make una dey sure say una keep una promise.
25 Reuben and Gad men come answer say, Sir, we go do wetin we don promise.
26 Our wives and children, and sheep and cattle go stay here in town for Gilead.
27 But those of us wey don prepare for battle go cross Jordan and fight for God.
28 Moses come tell Eleazar, Joshua, and family leaders say, Make sure say tribe of Gad and Reuben ready for battle and cross Jordan River with una. If dem do, then after una don capture the land, make una give them Gilead region as their own land.
30 But if dem break their promise, make dem get land for other side of Jordan, like other tribes.
31 Reuben and Gad men come answer say, Sir, we go do as God don command.
32 Under him command, we go cross to Canaan land, and go battle, so that we no go loose our property for east of Jordan.
33 Naso Moses give territory and towns wey King Sihon the Amorite don rule and territory and towns wey King Og of Bashan don rule to tribe of Gad, Reuben, and half of Manasseh.
34 Tribe of Gad rebuild towns of Dibon, Ataroth, Aroer,
35 Atroth-Shophan, Jazer, Jogbehah,
36 Beth-Nimrah, and Beth-Haran. Dem build walls round, and dem also build where dem go keep their sheep and goats.
37 Tribe of Reuben rebuild Heshbon, Elealeh, Kiriathaim,
38 Sibmah, and the town wey dem dey call Nebo and Baal-Meon before. Dem take all of them.
39 The clan of Machir wey come from tribe of East Manasseh go to Gilead region, capture the town, and force the Amorites out.
40 Naso Moses give the Machirites the region of Gilead, and dem settle there.
41 Jair wey come from Manasseh tribe take villages and call them Villages of Jair.
42 Nobah capture town of Kenath with the villages, and call am Nobah.